Lucy and Erica fight BBNaija: Nengi, Dorathy, Ozo, all oda housemates wey fight inside Big Brother Naija lockdown house in just 24 days

Erica

Wia dis foto come from, @BBNaija Twitter

Wetin we call dis foto, Ozo try to calm down Erica during her clash with Lucy

Big Brother Naija housemates Erica and Lucy quarrel each oda well-well for di house afta dem finish dia task challenge on Tuesday, August 1,.

Kasala burst afta Lucy tell Kiddwaya say Erica na di head and Kiddwaya na di neck 'and if you say di head no dey turn,den e no dey turn'.

Afta she tok finish Erica ask her wetin her statement mean, na dia di gbas-gbos start between di two of dem.

Di two ladies settle later in di evening during dia rehearsals for dia Thursday task.

Erica BBNaija

Wia dis foto come from, BBNaija

Erica hug Lucy from behind na so Lucy take di opportunity to tell Erica say she bin dey joke and say she no mean am at all, Erica respond say: "I dey sorry, I bin dey angry."

But no be only dem wey don fight inside di house since di season start.

See all di fight wey don shele for Big Brother Naija lockdown house.

Vee and Dorathy fight

Vee and Dorathy fight start for di Guinness task, Di wahala start wen dem cover Vee eye as she dey kick di ball to di net, some housemates bin dey laugh di tin make her vex well-well.

As Vee manage finish her turn she shout immediately say "Whoever bin laugh for dat group, I swear to God, no ever tok to me again!" no be only dat one she tok, she use some kain strong language too.

Neo and Kiddwaya try use play-play to make Dorathy and Vee to sitdon tok but di two ladies no gree speak to each oda.

Nengi and Lucy wahala

Lucy and Nengi wahala

Wia dis foto come from, BBNAIJA Youtube

Wetin we call dis foto, Lucy and Nengi wahala

E no dey clear wetin truly cause Nengi and Lucy to quarrel but di banta happun afta Sunday night double eviction Live Show wia Eric and Tochi leave Biggie House.

Di argument start wen Lucy wey bin dey inside bathroom and Nengi come hear something wey she tok, then she come ask Lucy if she dey refer to her. Na from dia serious gbas gbos come start and two of dem come begin dey insult each oda.

Ozo and Prince kwanta

Ozo and Prince

Wia dis foto come from, BIGBROTHER NAIJA/AFRICA MAGIC

Ozo and Prince kwanta during rehearsals for dia Thurdsay Wager Challenge.

As dem dey do rehearsal for dia music drama, Prince waka comot from di rest of di Housemates and Ozo no take am funny. For di first time, Ozo begin rake no be small.

But Prince just dey calm, so di quarrel no turn fight. Trikytee bin also step in to control di matter.

E no reach one minute, Ozo calm down come tok sorry to di House unto say im lose im temper. Im also tell Prince sorry say im shout on am, while im dey explain to Prince say e dey disrespectful to di House as im walk out.

Ka3na and Tolanibaj 'gbas-gbos' sake of food

Ka3na fight with Tolanibaj

Wia dis foto come from, AFrican Magic website

Di whole situation start for kitchen wen, Ka3na change am for Tolanibaj say she dish food afta she don eat early in di morning.

Tolanibaj change am back for Ka3na say dis her pattern around food no go work at all. Dis whole tin cause serious gbege for di house.

Dem cause each oda well-well before Head of house Ozo call all di housemates for meeting to settle di mata.

Ka3na and Whatoni gbege

Wathoni and Ka3na fight

Wia dis foto come from, BBNAIJA/TWITTER

Wathoni, and Katrina AKA Ka3na fight na di first disagreement for di season.

Dia gbege start wen Ka3na tell Wathoni say she no get right to call her name like dat.

She add say "if you call my name, I will finish you. If you get issues wit me, face me and tell me".

According to Ka3na, she don show everyone inside di house her real character and she no be fake girl so if Wathoni or any oda pesin no fit stand her, make dem no come close to her.