Big Brother Naija housemates biography: Wathon and Ka3na fight - Kate Jones AKA Ka3na and Florence Wathoni Anyansi na first two fighting among BBNaija 'Lockdown' Season 5

Wia dis foto come from, BBNaija/Twitter
Wetin suppose be one fun Trivia turn sour on Friday night for Big Brother Naija live television reality show.
Two housemates inside Biggie house, Wathoni, and Katrina AKA Ka3na fight over a disagreement to become di first two fighting in BBNaija House 2020.

Wia dis foto come from, BBNaija housemates
Inside di video, Ka3na dey tell Wathoni say she no get right to call her name like dat.
She add say "if you call my name, I will finish you. If you get issues wit me, face me and tell me".
According to Ka3na, she don show everione inside di house her real character and she no be fake girl so if Wathoni or any oda pesin no fit stand her, make dem no come close to her.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Deputy Head of House: Wathoni, na 29-year-old fashion entrepreneur.

Wia dis foto come from, Bigbrother Naija/Africa Magic
Florence Wathoni Anyansi na 29-year-old fashion entrepreneur and she be single mother wey dey do her fashion business and parenting blog at di same time
She say she fit speak and write Swahili wella as her mama na from Kenya and her Papa na Igbo.
End of Di one wey oda users dey read well well
Kate Jones AKA Ka3na

Wia dis foto come from, Bigbrother Naija/Africa Magic
Kate Jones na 26 years old entrepreneur from Rivers State, Nigeria. She describe hersef as boss lady because she dey in charge of her life.
She say she want to dey famous, she like money wel-well and hate poverty. Her dream na to get di biggest luxury fashion brand for di world.












