Wyclef Police Ibadan: Police arrest viral video suspects in lady 'dehumanization' and sexual harassment for robbery case - Official

Wia dis foto come from, Getty Images/Screenshot/TwitterVideo
Nigeria Police don arrest all di remaining two pesins involved in di dehumanizing treatment of one female citizen in one viral video wey enta social media since Wednesday, 22nd July, 2020, bringing di total number of pesins now in police custody to four.
Di two additional pesins arrested na CPL Aiyedun Akeem and one Ope Owoeye - di civilian accomplice popularly known as 'Wyclef'.
Recall say Nigeria police don identify three officers, arrest two wey dehumanise lady for viral video.
"Following di investigate into didehumanizing treatment of one female citizen wey we see for viral video on Wednesday, 22nd July, 2020, di Nigeria Police Force don identify three (3) police officers and one (1) civilian wey follow dem participate for di unprofessional act." Police tok-tok pesin Frank Mba release for statement.
Dem earlier arrest two suspects ASP Tijani Olatunji and Inspector Gboyega Oyeniyi. Di statement add.
DSP Mba say dem don detain dem for di Lagos State CID detention facility for Panti, Yaba.
Wetin go happun to all di suspects arrested in Wyclef Ibadan Police viral video?
Meanwhile, Police Detectives from di State CID, Panti, Yaba, Lagos don establish contact with di victim wit assurances say justice will not only be done but will be seen to have been manifestly done.Investigation still dey ongoing after which di Police Force internal disciplinary procedures go begin for di officers. Nigeria Police Force tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Di IGP bin order investigate afta di video of one woman for Ibadan, South West of di kontri, wey police dey molest, go viral.
End of Di one wey oda users dey read well well
For inside di video, dem handcuff di lady wey dem meet for di house wia dem wan go arrest one suspected armed robber.
Dem handcuff di woman wey say her name na, Towobola, record di video while dem dey question her on her sexual relationship wit di suspected robber.
Di video make pipo para for social media.













