BBNaija Lucy and Nengi fight: Toyin Lawani and Bobrisky react to eviction night roommate quarrel afta voting for Big Brother Naija housemates 2020

Wia dis foto come from, Instagram/Nengi and Lucy
Di quarrel wey happun between Lucy and Nnegi for Big Brother Naija lockdown house no end dia as two Nigerian celeb don clash on top di mata.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, BBNaija
Nigeria celebrity stylist, Toyin Lawani put up one post about her past experience and tag only Lucy for her di long write up for di Instagram post.
Toyin Lawani tok about how somebody yab her for doing Fibriod surgery and breast lump removal, yet di same pesin dey do everything to try to look like her.
Afta Toyin post, Nigeria popular cross dresser Bobrisky begin post foto of Nengi on top im page and hala say make dem leave Nengi alone without calling di name of di pesin e dey refer to.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Bobrisky later tok for anoda post say: 'Signing out !!!! No one should call me to order pls... If na Warri you wan carry me go dis time around. I'm ready for u.

Wia dis foto come from, BBNaija
Wetin cause Lucy and Nengi Quarrel
E no dey clear wetin truly cause di quarrel but di banta happun afta di BBNaija double eviction Live Show wia Eric and Tochi leave Biggie House.
Di argument start wen Lucy dey inside bathroom and Nengi come hear something wey she tok, then she come ask Lucy if she dey refer to her. Na from dia serious gbas gbos come start and two of dem come begin dey insult each oda.
At one point Lucy tell Nengi say "without a man, you no fit do anything," Nengi reply back and say "shut up your mouth."
End of Di one wey oda users dey read well well
Two of dem insult each oda so tey Nengi tell Lucy say she be "old woman." and Lucy wreply say "I be 30 and I look better than you!"
Lucy say Nengi dey change man every week; 'One week one man' and Nengi say wetin concern her.











