BBNaija 2020 eviction: Eric and Tochi don comot from Big Brother Naija season 5 edition

Eric and Tochi don comot for big brother naija house

Wia dis foto come from, InSTAGRAM

Eric and Tochi na di latest housemate to comot from di Big Brother Naija season 5 lockdown house afta like three weeks for di house.

Dem dey part of di four housemates wit di lowest votes from fans of di reality show dis week.

Fans bin get until Thursday 10pm to cast dia votes to keep dia favourite housemates for di game.

Di housemates wey enta di house for July 19 don spend 21 days out of dia 71 day journey so far.

Dis na five tins you need to know about dis Sunday eviction.

16 Housemates bin dey up for possible eviction

Dis week na 16 out of di 18 housemates dey up for possible eviction, only di head of house Ozo and im deputy Dorathy dey safe.

  • Victoria Adeyele AKA Vee
  • Timmy Sinclair AKA Trikytee
  • Terseer Kiddwaya
  • Praise Nelson
  • Florence Wathoni Anyansi
  • Tochukwu Okechukwu AKA Tochi
  • Kate Jones AKA Ka3na
  • Eric Akhigbe
  • Ngozi Nlewedim AKA Erica
  • Ezekiel Bright Osemudiame AKA Brighto
  • Aisha Umaru AKA Kaisha
  • Emuobonuvie Akpofure AKA Neo
  • Tolani Shobajo AKA Tolanibaj
  • Olamilekan Agbeleshe AKA Laycon
  • Rebecca Hampson AKA Nengi
  • Lucy

How di Live Eviction dey work dis season?

Ebuka Obi-Uchendu

Wia dis foto come from, @BBNaija Twitter

At least one out of di 16 housemates wey dey up for possible eviction go leave di show on Sunday and di house get power to decide who dat pesin go be.

Each housemate go get dia time to nominate one of di bottom four housemates wey get di lowest votes from di public inside di Diary room.

Di Housemates wey get di highest votes from dia fellow housemates na im dem go evict from di house.

Dis na di first time di organizers dey introduce dis kain tin for di history of di reality television show.

How di Head of house and deputy escape eviction?

Ozo na di first male housemate to become head of house.

Wia dis foto come from, @BBNaija Twitter

Wetin we call dis foto, Ozo na di first male housemate to become head of house

Ozo win di Head of House challenge on Monday to become di first man to lead di house for di week and by dat victory e get automatic immunity from possible eviction.

Im choose Dorathy as im deputy she sef get immunity sake of di title.

Channel to watch di live eviction show?

Fans fit watch di live Sunday eviction show for cable company DSTV for dis channels, 198 by 7PM for African Magic Showcase (DSTV Channel 151), African Magic Urban (DSTV Channel 153), African Magic Family (DSTV Channel 154 and Gotv channel 2).

How many housemates don leave di house?

Since di show start for July 19 na two housemates dem don comot for di house Ka3na and Lilo out of di 20 housemates wey enta di house.

Dis season housemates dey compete for di grand prize of N85 million naira.