How to vote on BBNaija 2020

Wia dis foto come from, BBNaija
Every week, for Big Brother Naija Season 5, 2020, Biggie dey put up all housemates wey no win Head of House and deputy for eviction, meaning.
E go come remain for fans of Nigeria biggest television reality series to decide who dem want make e stay and who dem want make e leave di house.
So far, 6 housemates, Ka3na, Lilo, Tochi, Eric, Kaisha and Praise don comot di house afta dem get less votes from fans and housemates vote dem out
How you fit vote your favourite BBNaija housemates
Three possible ways dey for you to cast your vote and you dey free to choose di way wey easy pass for you.
Mobile Site
Di number three way to vote na to visit Africa Magic mobile site.
Just cari ya fone, google Africa Magic, once you enta dia website you go find wia to vote.
Pesin wey choose to vote through website fit vote reach 100 times.
Voting through mobile site na FOC 9Free of Charge) but you go gatz pay for ya data.
End of Di one wey oda users dey read well well
DStv App
Anoda way you fit take vote for your favourite housemate na through di myDStv or myGOtv (dat na di ap of di organizers of di show, DSTV).
Here sha, di number of vote wey you fit to cast na based on which subscription package you dey do.
If na App you wan use, voting na free, but you go pay for data.
SMS
You fit vote through text message or SMS.
To vote through SMS, just type VOTE plus di name of di housemate as text message den send am to 32052.
If you dey vote through SMS, you fit vote reach 100 times and dem go charge 30 Naira for each time you sen di text.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post

Wia dis foto come from, BBNaija/Twitter
How di eviction dey be?
Inside dis season 5, Biggie introduce some kain new tins unto how Sunday evictions go be.
For dis Lockdown season, all housemates go dey up for eviction each week, except di Head of House and Deputy Head of House.
Housemates go do live eviction every Sunday. For di very first show, na di housemates go choose who among dem go go home.
Here, na turn by turn each housemate go take enta Diary Room to nominate one out of di four housemates wey get di lowest vote.
Housemate wey dem nominate pass n aim dem go evict.












