Big Brother Cameroon: What you need to know about Biggy 237 reality TV show wey resemble BBNaija

Biggy 237 poster

Wia dis foto come from, Cyril Akonteh

Cameroon di start e first reality show, Biggy 237 on August 2, 2020.

Di show go focus on peace and how pipo from English and French side fit live together.

Peace bi important especially for taim weh Cameroon di struggle wit Anglophone crisis and oda issues, Cyril Akonteh, de managing Director tell BBC Pidgin.

Weti you get for know about Biggy237

At de end of de show, de winner go get $17820 (FCFA 10million) plus gifts and dream trip for Dubai.

De concept di promote de two languages for Cameroon, di project and unite young pipo from from de two cultural backgrounds.

Since weh de world di battle Covid-19, de show go educate pipo how for live and cope, especially how for prevent and protect demselves from dis pandemic.

Na 25 young boys and girls of above 21 years go enta Biggy Mansion for August, 2, 2020 wit entry party.

But before now, deh go don pass dia medical exams and deh go check dem for Covid-19 before deh enta de mansion.

De bi don quarantine sef from 18 July afta deh bi don do plenti medical check-ups, HIV, hepatitis B and C, Chlamydia, chest X-ray and Covid-19 test.

From 27 July, deh contestants go meet for Denver Residence for isolation before de show proper start.

De housemates go tok English, French and pidgin and Francanglais.

Monday and Saturday na English, Tuesday and Friday, French, while Wednesday na for Pidgin, Thursday na Francanglais and Sunday na French and English.

De moral part of de show na say ecumenical service go dey where-priest, pastor, Iman go make joint service for Biggy Mansion for pray for peace for Cameroon.

Biggy 237 don create e own Biggy TV HD for Satellite under BT Media for wusai supporters go fit watch de show.