Church resumption in Lagos State: MFM, Synagogue, Daystar, oda churches wey no go reopen dis Sunday afta goment lift coronavirus lockdown order

Church resumption in Lagos State latest update

Wia dis foto come from, FACEBOOK/TWITTER

Wetin we call dis foto, MFM, Synagogue, Daystar, Covenant church Pastors
Read am in 3 mins

Some big churches for Nigeria wey get dia headquarters for Lagos State South West Nigeria don announce say dem no go resume church services for 9 August afta goment lift coronavirus lockdown order on worship centres.

Nigeria goment bin suspend religious gatherings for kontri since March to curb di spread of di virus.

Di Presidential Task Force on Covid-19 bin down allow di reopening of churches and mosques in di kontri for June but di Lagos State goment no gree allow worship centres for di state to reopen sake of di increase in coronavirus cases.

Dem later give go ahead for religious gathering to start on 7 August.

But some churches for di state don come out to say dem neva ready to reopen.

Di churches get different reasons for dia decisions, some say na to prepare di place for reopening wey go meet di safety protocols of di federal goment, others say dem dey wait to hear from God before dem reopen.

See di list of some churches wey no go open for 9 August:

MOUNTAIN OF FIRE AND MIRACLE MINISTRIES

Di leadership of Mountain and Fire and Miracle Ministries MFM tok say pipo no go gada together for service for all dia church regions, branches or zones wey dey Lagos and Ogun states until 13 September 2020 as dem wan put in place preventive measures against coronavirus and follow all di safety protocols wey federal goment, state goment and NCDC put for ground.

MFM on Church resumption in Lagos State

Wia dis foto come from, Daniel Olukoya/Facebook

Wetin we call dis foto, Daniel Olukoya na di Senior Pastor of Mountain of Fire And Miracle Ministries
Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

DAYSTAR CHRISTIAN CENTRE

Church resumption in Lagos

Wia dis foto come from, Sam Adeyemi

Wetin we call dis foto, Pastor Sam Adeyemi and im wife Adenike

Di popular Church for Lagos wey Senior Pastor Sam Adeyemi dey head say dem go continue dey hold services online.

Di leadership say dem go continue dia service like dat until dem fit guarantee safe environment for worshippers.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

SYNAGOGUE CHURCH OF ALL NATIONS

Di General Overseer for Synagogue Church of all Nations Pastor TB Joshua hail authorities for dia effort to prevent di spread of coronavirus and di announcement say churches fit resume but even though authorities don tok dia own, dem go like to hear from God.

TB Joshua on Church resumption in Lagos State

Wia dis foto come from, Twitter/@SCOANTBJoshua

Wetin we call dis foto, TB Joshua of Emmanuel TV

Pastor TB Joshua say afta dem hear from God, dem go tok wen services go resume for di church.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

FOUNTAIN OF LIFE CHURCH

Di church for twitter say dem go release di date wey dem go meet physically for church as dem go continue on line services for now.

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3

THE COVENANT CHURCH

Di Covenant Nation don fix 6 September as di date wey dem go reopen.

Poju Oyemade, Senior Pastor of The Covenant Church

Wia dis foto come from, Twitter/@pastorpoju

Wetin we call dis foto, Poju Oyemade na di Senior Pastor of Covenant Church and Convener of di Platform Nigeria.

Pastor Mrs Toyin Poju-Oyemade wey tok say online services go still continue for now.