BBNaija Erica and Laycon fight: Neo and Vee break up, Ozo confess to Nengi - See all di drama wey happun afta Saturday night party

Wia dis foto come from, BBNaija
Fans of di Big Brother Naija show dey react afta di kasala wey burst inside di lockdown Season 5 house on Saturday night.
Yawa gas wen Erica confront Laycon about di question wey Ebuka, di host of di show bin ask Laycon last Sunday about wetin im tell anoda housemate say Erica try to kiss her.
Erica ask Laycon to show proof say she try to kiss am aside from "di one time wey she bin high on alcohol", but Laycon no tok anything.
No be only Erica quarrel. Neo and Vee also get dia own issue while Ozo too bin wake up from sleep to confess im feelings to Nengi.
Wetin happun between Erica and Laycon
E first appear say Erica dey vex before di Saturday party end. She first start to dey vex with Kiddwaya say e dey dance with Nengi. But Nengi clear Erica say she no dey interested in Kiddwaya.
Na di mata Kidd, Erica, Ozo and Nengi go inside go settle before di party end den she face Laycon.
She use strong words wen she dey warn Laycon say make e tell her wen she try to kiss am aside from di one time she bin high on alcohol.
Erica use words like say Laycon dey "ugly", be "mopstick", and be like "drumstick".
End of Di one wey oda users dey read well well
Erica also use words like "death".
Erica also vex with Kidd and Prince say dem no pick side for di fight.
She pour water for Prince side of di bed as di Deputy Head of House and say e no go sleep with her for di same bed.

Wia dis foto come from, BBNaija
Even as Trikytee and Kidd try to calm her, she no hear.
"I feel like say I dey work around on egg shells, I don tire"
She tell Trikytee as e dey try to make her calm down. Erica say she dey ready her mind for di worst say wen she go report hersef to Biggie say she pour water ontop Prince side of bed, Biggie make her feel like say dey in serious trouble.
She say she sure say dem go disqualify her and she don read to go house.
She later apologise to di housemates di next morning.
Wetin remain na to see how Biggie go respond.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3

End of X post, 4

End of X post, 5

End of X post, 6
Vee and Neo fight
Vee and Neo fight start because of food. E no clear wen dia own quarrel start but wetin we see na Neo waka leave Vee for table enta room and dem begin quarrel. Neo tell Vee say e don ova.
Ozo and Nengi
Wen all di kasala dey burst Ozo bin dey sleep sake of di alcohol e take bin worry am.
Wen e wake up, na wen e and Nengi bin dey garden dey discuss e telll her say e go like spend d rest of im life with her. She no respond but change di topic before Neo waka come meet dem.