BBNaija live: See why Big Brother give Kiddwaya second strike and warn Erica

Wia dis foto come from, @BBNaija
Big Brother Naija 2020 housemate Kiddwaya don collect second strike for di reality TV show while Erica collect "strong warning" from Big Brother.
Di two lovebirds enta trouble afta Biggie review one video wia two of dem flip dia fingers face di camera, something wey di organisers of di show consider as "disrespect for Biggie authority."
Dis action from Kiddwaya come make Biggie issue am strike, im second since di show start and if im get di third one, im go chop immediate disqualification from di Big Brother house.
As for Erica, Biggie cut her strong warning for her actions wit Kiddwaya.
Fans bin dey fear say Biggie go disqualify Erica wey already bin dey on two strikes.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
No be di first time wey two of dem go break Big Brother house rules, only less dan a week ago two of dem bin enter soup unto some laws wey dem break.
Afta di video review, Biggie tell di two of dem say: "dia actions no get any other words to describe dem but na serious disrespect to Big Brother and di viewers."
Im even use di opportunity to reveal say Nengi and Prince don win VVIP trip to go Dubai for dia efforts for di Pepsi game task wey dem bin win during di week.
End of Di one wey oda users dey read well well












