Anglophone crisis: Three recent kidnappings for di region weh shock pipo

Wia dis foto come from, Kumba/Facebook
kidnappings di kam back strong-strong for Anglophone regions sotei for inside one week, three different kidnappings don happun afta deh bi don reduce small.
Since weh Anglophone crisis enta fighting level for 2017, kidnapping don become part of de means for push dia agenda or get moni or punish pipo weh deh claim say deh no di respect dia rules.
Three kidnappings for one week show how de situation for Anglophone regions bad even if toks di go up and down for ceasefire.
Separatists kidnap teacher for Bamenda
De latest Polycarp Wirayen, teacher for Government Bilingual High School. De teacher bi dey road for go invigilate computer science e exams as Cameroon di write official exams now wen deh kidnap e July 20.
Deh ask de teacher why e get for go supervise wen goment forces di kill separatist fighters everyday.
Inside de video weh e circulate online, de kidnappers say de reason na for send message e for across for oda teachers.

Wia dis foto come from, Red Dragons of Kumba/Facebook
Separatists kidnap former Bamenda goment delegate e woman
Separatist kidnap Hilda Ndumu, woman for Vincent Ndumu weh e bi na big mayor- government delegate for Bamenda City Council for Friday July 17 for Northwest region.
Dis wan happen four days afta de Lebialem kidnap. For dis one, de tori no bi clear why de kidnap dis woman but deh free e for Saturday, July 18.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Red Dragons of Kumba/Facebook
Separatist kidnap 63 young pipo for Lebialem, SW region
Tori waka last week as separatist fighters kidnap, 63 young boys and girls dem for Lebialem, for Southwest region, ask make dia families pay moni for July 13.
Na group for Colonel Ayeke (Gorillas) bi claim say deh kidnap de young boys and girls. Army enta inside de mata and later deh free dem.
Dis kidnappings di target all man, church pipo, politicians, teachers, school pikin dem and pipo weh separatist believe say deh no di obey dia rules.
Some kontri pipo say just now, di check say plenti of de boys weh deh still hold gun no di fight na Anglophone course but dia pocket and settle scores. Kidnapping na one way for make moni, settle scores.
Some di argue say deh no fit di kidnap di harm de pipo weh deh claim say deh di protect.
De kidnaps di happen for taim weh army di carry out operations for some parts for Northwest region and deh kill 15 separatist fighters.
Rights groups and kontri pipo di condemn kidnappings and oda atrocities weh separatist and goment forces di commit as Anglophone crisis weh e start for 2016 di go on just now.













