NEPA: Why electricity workers strike make light no dey for Nigeria

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria currently no get light as electricity workers begin indefinite strike on Wednesday.
National Union of Electricity Employees (NUEE) bin embark on nationwide strike to protest di industrial issues for di sector.
For statement wey di union bin release dem say "di ministry of power fail to resolve some issues wey dey affect members of di union since 2013 wen dem privatise di power sector especially issues over 2,000 former PHCN workers and dia pay off."
Anoda tin wey make dem decide to strike na di unresolved issues around illegal transfer of union properties to power investors and some distribution companies deduction of staff pensions wey dem no remit give pension managers.
But on Thursday morning tori comot say dem don suspend di strike and some of di distribution companies like Eko Electricity Distribution Company don "open dia offices for business".
Leader of di NUEE, Joe Ajaero tell BBC Pidgin say "We suspend di strike and not called off.
"We don do di tok-tok with goment for us to see di implementation of di agreement. So if goment no dey serious wit am, we go go back to strike action."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Godwin Idemudia wey be Head of Corporate Communication for Eko Distribution Company tell BBC Pidgin say di distribution companies go bring light now as dem don suspend di strike.
End of Di one wey oda users dey read well well













