Nigeria Social Media Bill and Hate Speech Bill dey different, no confuse di two

Nigeria Senate
Read am in 3 mins

Nigerians don dey make #SayNoToSocialMediaBill trend for nearly two weeks now, but di tins wey make some pipo vex dey inside anoda bill.

E fit be say some pipo dey confuse di two?

Di Hate Speech bill and Social Media bill don cause serious tok tok about how di Nigerian goment wan use am silence pipo online not to tok dia mind on governance and leadership mata.

Nigerian activist Deji Adeyanju don already announce on Sunday say National Assembly go get visitors on Wednesday 27 November as im dey organise pipo to go protest di two bills.

Di Social Media Bill

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Di Social Media Bill wey don make pipo para

E dey important to torchlight say di Hate Speech bill no mention anything about "online" or "social media", although di way Senator Abdullahi Sabi - di sponsor - take write am, pesin fit reason am say e cover join.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

According ti document, di purpose for di 'National Commission for di Prohibition of Hate Speeches' na to target "any pesin wey use, publish, present, play, provide, distribute and/or direct di performance of any material, weda dem write am or show am, wey fit ginger ... ethnic hatred".

Di Hate Speech bill

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Di Hate Speech bill bin get death penalty inside

But di Social Media Bill, wey some human rights joinbodi and oda pipo don torchlight say na copy-copy of one new Singapore law, get many tins wey no dey straightforward inside.

Di document of di bill say na to "stop facts about Nigeria wey dey false". But how di law go take determine wetin no be truth, di bill no tok am and na why some pipo feel say goment wan use di law silence any bodi wey im yan no favour dem.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Di actions by Nigerians wey no want di bills

Some ogbonge pipo and 'influencers' don use di power of social media to make sure say hashtags about di bill, especially di Social Media bill don dey trend for almost everyday.

One online petition for change.org wey dem start on 23 November don already get over 70,000 signatures by Monday. Anoda petition wey dey notify United Nations to chook mouth for di mata don gada 30,000.

Although, Yemi Adelamolekun wey be founder of Enough is Enough Nigeria (EiE) tell BBC say high number of pipo wey sign petition no mean say Nigerian lawmakers go torchlight or change di bill, like di way e be for United Kingdom.

Shineyoureye.org website

Wia dis foto come from, Shineyoureye.org

Wetin we call dis foto, All pesin need to do na search for di name or area

One pesin even do app put for Google Play Store wey im call 'Let Them Know', wey fit make pesin see all di names of Senators for Nigeria, dia phone numbers and easy way for ordinary citizens to send email to lawmakers say dem no want di Social Media bill.

And how about House of Representatives members? Anoda joinbodi decide to do website to see who be who and dia contact informate. Dem call am 'Shine Your Eye'.