Bayelsa, Kogi election final result: Buhari tell Nigeria main opposition PDP to accept defeat wit grace

President Muhammadu Buhari recieve Governor-Elect of Bayelsa State, David Lyon for State House on Monday.

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency

Read am in 3 mins

President Muhammadu Buhari receive Governor-Elect of Bayelsa State, David Lyon for Aso Rock Abuja on Monday where im go present im sef as di tear-rubber Govnor from Nigeria ruling APC party.

Afta Nigeria election office - Independent National Electoral Commission - Inec declare Yahaya Bello winner of di Kogi State govnorship elections, opposition Peoples Democratic Party - PDP don reject both di Kogi and Bayelsa results.

But President Buhari wey don sama congratulobia give all di winners wey be members of im party also tell di main opposition PDP to accept defeat wit grace.

Di All Progressives Congress (APC) win di November 16 Governorship elections inside Kogi and Bayelsa States, increasing di number of states wey dem dey control to 19 of the 36 states across di kontri.

For di February general election, wey President Buahri take win second term, im party lose five govenorship seats, according to statement from Buhari tok-tok pesin Garba Shehu on Monday.

Di time wen APC lose nobodi complain and di Buhari goment bin accept di results, so make PDP no cry say dem be victim dey attack di election office - Inec, Oga Shehu add.

"Congratulations to Govnor Yahaya Bello on im re-election. Na race well run and victory well won. I wan encourage am to use dis second term as opportunity to build on di foundations im don already lay down to improve lives of di pipo of Kogi State," Buhari bin write ontop Twitter.

Yahaya Bello and Muhammadu Buhari dey shake hands

Wia dis foto come from, Twitter/MBuhari

Meanwhile, di main opposition party Peoples Democratic Party and dia candidate Musa Wada, don reject di "outcome" of di election.

Dem say no election happun on Saturday 16 November 2019 but instead na "war against di people" take place.

Inside statement wey PDP release on Monday, dem accuse APC say dem carry police helicopters begin attack pipo wey come out to vote, and say dem use "thugs to shoot and kill voters, snatch ballot box".

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Even though Buhari say im sorry for di violence wey thugs cause during di election, di president say na "di work of di political sponsors wey send dem" di thugs bin dey do.

Reactions from social media to Kogi and Bayelsa election final result

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Skip X post, 3

End of X post, 3

Some doubt say true true Bello fit get di kain number of votes wey INEC say im get (402,222).

Skip X post, 4
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 4

Odas decide to give pipo di power to act like Inec. Dis account do online poll to ask pipo to judge how di elections go.

Skip X post, 5
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 5

Kogi State na home to over four million pipo and e get three main ethnic groups: Igala, Ebira, and Okun.