Court order P&ID to close shop, forget dia assets for Nigeria

Federal High Court symbol for Port Harcourt

Wia dis foto come from, BBC

Federal High Court for Abuja on Thursday order Process and Industrial Development Limited (P&ID) and P&ID Nigeria Limited to close dia operation and hand over dia assets to Nigeria goment.

Justice Inyang Ekwo ask P&ID Nigeria Limited, wey be di second defendant, to forget dia assets to di Federal Government of Nigeria.

Justice Inyang Ekwo give di order afta di kontri Economic Financial Crimes Commission (EFCC) drag di companies go court ontop accuse say dem bin plan to obtain goment, deal on petroleum products without di right license, money laundering and say dem no register P&ID di way di law require.

Di judge rule afta di representatives of di companies plead guilty to di 11 charges wey EFCC carry go dia domot.

Di defendants, no object as dem plead guilty to all di charges.

Dis wan dey come afta Nigeria goment promise to appeal and investigate one British court decision wey order dem to pay $9 billion worth of asset to (P&ID) ontop accuse say Nigerian goment no keep to one 2010 agreement to build natural gas plant for di kontri.