DJ Arafat: Fotos of Davido, thousands wey pay tribute for di "king" funeral

DJ Arafat mama dey cry for di front of di coffin

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di concert, wey di Ivorian government join hand sponsor, happun for Abidjan on Friday just before di funeral

Thousands of fans don gada for Ivory Coast capital Abidjan to pay tribute to musician DJ Arafat.

Di 33 year old Ivorian real name na Angie Didier Huon and e die for a motorcycle accident earlier dis month.

Ivory Coast Presido, Alassane Quattara dey among di hundreds of Ivorian artists wey attend di stadium concert dem organize for am.

Davido for DJ Arafat funeral

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Nigeria musician Davido bin dey down as im look di face of im friend for di last time

Dem carry Huon coffin enter di stadium before dey come carry am go di cemetery wia dem go bury am.

Fans attend a tribute ceremony

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, DJ Arafat na musician wey influence di industry for France and West Africa

Di concert bin happun afta one online petition wey call on goment to allow di concert and funeral happun for di Félix Houphouët Boigny stadium, wey fit seat 35,000 pipo.

DJ Arafat

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, For 2016 and 2017, DJ Arafat collect artist of di year for di Coupé-Decalé Awards

Di goment pledge $250,000 for di event and promise to sponsor di expenses for DJ Arafat burial.

Malian singer Sidiki Diabate and Ivorian Defence Minister Hamed Bakayoko on stage

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Malian singer Sidiki Diabate and Ivorian Defence Minister Hamed Bakayoko dey among di pipo wey follow dey for di concert

DJ Arafat na one of di most popular musician for francophone kontries. Pipo dey call am and "king" of coupe-decale, one special kain dance.

Dem born DJ Arafat for early 2000s, di time wey civil war dey for Ivory coast. Pipo begin sabi am because of im flashy lifestyle.

One fan of DJ Arafat waka for di ceremony

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, "Les chinois" (Di Chinese) na di name wey Huon fans dey call demsef because dem plenty well well

DJ Arafat come later dey famous for di flashy clothes, and di big man lifestyle wey pipo come sabi wit di music. Di music style na one wey get fast beat, deep bass and vocal wey resemble hip hop own.

Many sabi DJ Arafat say im like motorcycles well well and im e show am inside di video of im recent hit, Moto Moto, wey im release for May. Di song don get 5 million views ontop YouTube.

Di pikin of late Ange Didier Houn, also known as DJ Arafat

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Huon pikin dem also tok for di ceremony wey happun for Felix Houphouet-Boigny stadium

E release 11 albums over im 15-year career, and e collect artist of di year for di Coupé-Decalé Awards for 2016 and 2017.

Dem give am posthumous nomination for two All Africa Music Awards.

Fan dey cry for DJ Arafat burial

Wia dis foto come from, Getty Images

Fans react during tribute ceremony

Wia dis foto come from, Reuters