Libya attack: At least 40 pipo don die for one detention centre

Wia dis foto come from, Reuters
United Nations say di air strike wey kill more dan 44 migrants for one detention centre outside Libya capital "amount to di level of war crime".
Tori be say most of dead na sub-Saharan Africans wey dey try reach Europe by sea form Libya.
Tok tok pesin for di International Organisation for Migration, Florence Kim, tok say Nigerians dey among di pipo wey die.
More dan 130 pipo also injure for di attack, Libya gofment and warlord Gen Khalif dey blame each oda for di attack.
Gofment dey hold thousands of migrants for detention centres.
Wahala don dey for di kontri since dem comot di kontri former ruler Muammar Gaddafi, kill am for 2011.

Wia dis foto come from, AFP
Di Gofment of di National Accord (GNA) wey get United Nations backing, Prime Minister Fayez al-Serra, don tok say na di Libyan National Army (LNA) commit di Tuesday strike. But tok-tok pesin for di LNA tok say dem no attack di detention centre. Di LNA, wey dem oga be strongman Khalifa Haftar, bin don dey fight di GNA forces for di area wey di strike happun.
Thousands of migrants wey dey try travel go Europe na dem dey lock for dis kain detention centres wey dey close to wia fight-fight dey happun.
End of Di one wey oda users dey read well well














