Offa robbery: Police don arrest seven pipo afta robbers kill 17

Wia dis foto come from, Ayobami Agboola
- Author, Daniel Semeniworima
- Role, BBC Pidgin, Lagos
- Read am in 1 mins
Di number of pipo wey die for Thursday armed robbery attack for Offa town inside Kwara State for north central Nigeria don increase to 17, according to police.
Kwara State police talk-talk pesin Okasannmi Ajayi tell BBC News Pidgin say out of dis 17 pipo, nine na police and eight na civilians.
Some tori pipo dey report say na 30 pipo die but DSP Ajayi say na 17 pipo police know say don die for di attack. Im say odas wey wound dey for hospitals for Offa and University of Ilorin Teaching Hospital.
Di Police PRO talk say 'na seven suspect we don arrest. We also don recover seven motor and some phones dem wey di robbers use carry out di attack'.
Im also add say di state govnor Abdulfatah Ahmed don announce five million naira reward for anypesin wey get informate wey go help to catch di pipo wey do di attack.
Wetin bin happen for Offa
Tori be say, di armed robbers wey come di area for di one hour operation fit reach up to 30.
Di robbers land di area for 4pm Thursday 5 April, block road den enta plenty commercial banks and di police station wey dey di area wia dem kill nine policemen wey include one pregnant policewoman.By di time di robbers finish dia bad-bad work, dem don steal millions of naira.
Inspector General of police don send im special intelligence unit enter Offa town to investigate di mata and dem don also open di area make pipo for return back to dia normal life.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Offa na mainly yoruba speaking area for Kwara state north central Nigeria with Muslim and Christian pipo wey dey live together.











