Liberia Election: 'We never announce result yet'- Henry Flomo

Wia dis foto come from, Getty Images
Di oga for Liberia national election commission don talk say dem never announce result of who win for di run-off presidential election wey dem do December 26.
Henry Flomo, wey be di communication director for di commission tell BBC tori person Igho Williams say counting still dey go on, and di result go begin dey come out by tomorrow and Friday.
Meanwhile, rumour bin dey fly up and down, after one of di candidate, George Weah enter Twitter to thank people wey come out to vote.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
For di headquarter of George Weah im Coalition Democratic Change(CDC) party, some supporters don already dey happy and celebrate say na dia person win.
One of dis supporters, Eddie Tarawali tell BBC tori person Umar Fofana why dia belle dey sweet dem: ''supporters of di Coalition for Democratic Change dey for happy mood because we don already know of di result. We arrange all our strategic systems well for ground."
"We know our result from our war room. We get more than three different war rooms wey di party arrange for ground. So automatically, wen di process dey go on, we gather all of our information wey go make di CDC to win.''

Wia dis foto come from, Getty Images
But e no no dey like dat for di central Office of di governing Unity Party of Vice President- Joseph Boakai wey be di second candidate for di election.
Di few supporters wey dey there no get any smile for dia face. One of dia youth leaders still get confidence say na dem go win.
End of Di one wey oda users dey read well well
Whroway Bryant tell BBC say: "Progressive! Progressive! We get our poll watchers for field and all di polling centres. And dem dey do our counting plus give us di result."
As all dis one dey happen, di communication director for di national election commission talk say dem no get control over di mood of people wey dey celebrate and wey no dey happy, as dem never announce any result yet.










