West Africa: Wetin be di good and di bad news for 2017?

Wia dis foto come from, Getty Images
Remember when you dey wish for 2017, make you use am do better with your life? Well, dat no be yesterday because di end of di year don land.
So, make we look wetin be some of di good and bad things wey happen dis year.
Good moments for 2017

Wia dis foto come from, WIZKIDAY/TWITTER
Wizkid Performance for London
If you wan look for one person wey win for 2017, na Wizkid.
For September, im shut down di Royal Albert Hall for London, UK even after im start di performance two hours late.
Also, im break record as im become di first African to collect award as best international act for di Music Of Black Origin (MOBO), where im flog people like Jay-Z.

Wia dis foto come from, Getty Images
Bastie v. Banku
Bukom Banku chop im first losing for im career dis year but e sweet di mind of plenty people, because im bin dey boast say e be "Ghana Mayweather".
Na for round 7 na im Bastie Samir beat am to stop im unbroken run.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di World Cup Qualification
As 2018 na year of di Russia World Cup, dis one make dis year qualification season.
End of Di one wey oda users dey read well well
Nigeria qualify for di 2018 World Cup like film but for di middle of di qualification, dem don start to yab Ghana wey no qualify.

Wia dis foto come from, AFP
Cameroon carry di 2017 AFCON Cup
For February, Cameroon win di African Cup of Nations for di first time in fifteen years.
Dis one sweet dem belle sotay President Paul Biya take congratulations baff dem for Unity Palace.

Wia dis foto come from, AFP
Free SHS education for Ghana
Dis year President Akufo-Addo release new policy say dem go dey fund di secondary high school (SHS) education.
Dis one mean say to get senior education no go cost money again, although now e still dey pilot stage wey mean say dem just wan start.
Bad moments for 2017

Wia dis foto come from, Getty Images
Slave Trade for Libya
One of di biggest tori dis year wey hit people for head like stone na when di tori comot say dem dey auction people for Libya.
Dis one don make di Nigerian and Ghanaian government start to dey put head together, dey arrange, so dar dem country people fit come back house.

Wia dis foto come from, Getty Images
Floods wey full everywhere
Water become major problem for people for world dis year. Mostly, for Sierra Leone, where mudslide bin carry pass 400 people to dia death near Freetown.
People for dia begin dey vex, dey blame government say na because dem bin no get better urban planning. Even for Nigeria for Benue state, flood drive more than 100,000 people comot house.

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI
Secession plan wey no work
For Nigeria and Cameroon, October 2017 na time wey many of dem no go quick forget . Dis Biafra bin get plan to comot Nigeria and Ambazonia bin get plan to comot Cameroon.
As at now, thousands of refugees don run comot Cameroon to Nigeria sake of say dem dey run for dia life,
For Nigeria, dem still dey find Nnamdi Kanu, wey be one of di people wey bin dey push for Biafra.

Wia dis foto come from, Getty Images
Rochas Okorocha and im statues
Rochas Okorocha dis year do plenty things wey make people begin dey scratch head. First na when im start to dey comot wrapper from statues wey im do for African leaders for Imo state, Nigeria.
Another one na when im name im sister as Commissioner of Happiness, e no really work because around dat period people bin start to vex on top say dem no see salary collect.

Wia dis foto come from, Getty Images
Alex Ekwueme die
Na dis year, di first vice president wey Nigeria ever get, Alex Ekueme die. E pain people well-well.
E bin go London because im get chest infection and na for dia im die.











