Newcastle vs Arsenal highlights: Ben White own goal, Bruno score, Arteta bring Lacazette, Martinelli, Pepe but Gunners still lose

Wia dis foto come from, Getty Images
Arsenal hopes of finishing for di top four of di Premier League hit rock as dem lose 2-0 to Newcastle for St James' Park.
Mikel Arteta side bin need to win to move above Tottenham into fourth and put dem for better position to secure a Champions League spot ahead of di final match of di season dis weekend.
But dem end di game as second best throughout and fall behind early for di second half wen Ben White score own goal.
Bruno Guimaraes round up di game wit di second goal.
Arsenal no perform well for di match. Newcastle suppose score more goals. Di gunners dey fifth position.
See how di match go

Wia dis foto come from, Getty Images
Second half don start;
45 mins: Newcastle 0-0 Arsenal
45+1: Schar go down wit injury afta e clash wit for a 50-50 ball wit Nketiah.
48 mins: Substitution. Newcastle remove Schar bring in Lascelles afta di concussion assessment.
50 mins: Foul. Xhaka set leg for Almiron wey wan run pass am.
53 mins: Substitution. Smith Rowe enta for Martinelli.
53 mins: Goal! Callum Wilson put Newcastle ahead. Dis na im first goal of the year.
Newcastle 1-0 Arsenal
62 mins: Arsenal try press but e end wit poor finish from Martinelli.
63: Substitution. Arsenal bring in Lacazette for Tavares.
69 mins: Newcastle left-back Matt Targett go down wit injury and Kieran Trippier dey warm up just in case.
73 mins: Newcastle counter attack wit Krafth wit so much space.
74: Substitution. Pepe replace Gabriel.
76 mins: Substitution. Newcastle make two changes. Murphy and Fraser enta to replace Almiron and Saint-Maximin.
80 mins: Pepe lose ball wey e suppose pass come allow Newcastle players collect ball run dem on counter. But Ramsdale save di shot from Murphy.
82 mins: Wilson hit ball from 40 yards to score as e notice say Ramsdale dey outside di box.
85 mins: Goal! Newcastle 2-0 Arsenal. Bruno score from rebound.
89 mins: Arsenal top four hope don turn to smoke.
Newcastle 2-0 Arsenal
90 mins: Saka move into dangerous position about 20 yards out but e no end move wit beta effort. 6 mins added time.
90+2: Arsenal just dey misplace passes all over.
90+3: Substitution. Newcastle comot Wilson bring in Dwight Gayle.
90+6: Newcastle almost score di third goal. Ramsdale save shot from Fraser.
Full Time; Newcastle 2-0 Arsenal
Kick off, First half;

Wia dis foto come from, Getty Images
Match don start Arsenal fit go back to di top four?
2 mins: Newcastle 0-0 Arsenal
4 mins: Offside. Almiron show im usual speed to force di ball go front.
6 mins: Arsenal attack wit Nketiah. Elneny follows up im short wey Newcastle defender block go corner.
7 mins: Arsenal cut out ball into Callum Wilson and start counter-attack wey end wit anoda shot from Eddie Nketiah.
8 mins: Beta first touch by Newcastle left-back Matt Targett to control cross-field ball and nutmeg Takehiro Tomiyasu.
12 mins: Offside! Wilson don get three offside already for di match already. Joelinton give am pass from back.
13 mins: Lively start by di Magpies. Dia fans dey ginger.
Newcastle 0-0 Arsenal
15 mins: Saint-Maximin get im first chance to run to Tomiysau.
16 mins: Everytin look easy for Newcastle at di moment.
18 mins: Almiron miss chance to score afta pass from Bruno from di side in di box. Arsenal keeper Ramsdale parry di ball.
19 mins: Arsenal clear ball from di corner. Xhaka win di first ball.
21 mins: Arsenal get put Saka for one-on-one wit Targett afta beta one-two pass wit Odegaard inside di box.
24 mins: Newcastle keeper save anoda shot from Saka again.
25 mins: Arsenal don try stabilise di game for some minutes now, but Eddie Nketiah enta offside as e run into Bukayo Saka ball.
27 mins: Almiron run back but di ball comot from im leg towards Gabriel but Newcastle win di first contact and complete the clearance.
30 mins: Newcastle get back to back corner. Targett find di right delivery but Joelinton no dey enof to keep di ball.
31 mins: Bukayo Saka clear di corner but Newcastle win di ball back.
33 mins: Saint-Maximin show dey worry Arsenal wit im pace but Tomiysau dey try hold am down.
36 mins: Ramsdale save shot from Saint-Maximin from di left. Di shot from 20 yards go corner.
38 mins: Tomiysau be like e don get injury. E dey hold im hamstring. Cedric dey warm up.
39 mins: Substitution for Arsenal. Cedric enta for Tomiysau.
41 mins: Newcastle don really push Arsenal go back. Dem don take control of di game.
43 mins: Aaron Ramsdale punch cross from corner comot but Newcastle collect di ball again. Di Magpies dey hold di possesion 70%.
Half Time; Newcastle 0-0 Arsenal
Newcastle vs Arsenal head to head

Wia dis foto come from, Getty Images
Arsenal don win 18 of dia past 19 league and cup meetings wit Newcastle. Except for a 2-1 league defeat wey dem suffer for St James' Park for April 2018.
Newcastle don play seven competitive games without scoring against Arsenal since Ciaran Clark 91st-minute consolation effort wia dem suffer 2-1 defeat for di Premier League home defeat for September 2018.
A win for di Monday night match go carry Newcastle go 46 points, dia highest tally since returning to di Premier League five years ago.
Victory go also ensure say dem reach 30 top-flight points for home in a season for di first time since 2011-12.
Di Gunners don record five wins and five defeats for dia past 10 Premier League fixtures.
Dem dey one short of equalling di club record for most Premier League defeats of a 38-game season: 13, wey dem set for 2017-18 and 2020-21.
Arsenal don win eight league matches without clean sheet since dia 1-0 win at Aston Villa on 19 March.
Newcastle vs Arsenal Line up
Newcastle United: Dúbravka, Krafth, Schär, Burn, Targett, S Longstaff, Guimarães Rodriguez Moura, Joelinton, Almirón, Wilson, Saint-Maximin.
Arsenal: Ramsdale, Tomiyasu, White, Gabriel, Tavares, Elneny, Xhaka, Saka, Ødegaard, Smith Rowe, Nketiah
Newcastle vs Arsenal prediction
Arsenal endure a horrible night on Thursday for di north London derby but dem no fit allow dat one affect dem.
E dey typical of Arsenal to easily collapse wen sometin go against dem - sometimes dem be like say dem dey strong mentally but no be so.
Dem dey under pressure now. Arsenal must win for St James' Park or dem go finally comot from fourth place.
Newcastle don improve well well over di past few months and dem don show strength for dia home for St James' Park.
To beat dem dia go hard.
Prediction: 1-1
Dey refresh dis page for live update of di match







