Ghana vs Nigeria highlights: Black Stars and Super Eagles play 0-0 for Baba Yara Stadium Kumasi

Wia dis foto come from, Getty Images
Ghana and Nigeria face-off for di Fifa World Cup Playoffs for a chance to qualify for di world cup for Baba Yara Stadium for Kumasi end for 0-0.
Ghana and Nigeria get plenti chances but dem no convert any one.
Pressure bin dey well-well for di Super Eagles defence.
Di Ghanaian defence too bin feel pressure from di Super Eagles.
Di rivalry of di two kontris no dey end sake of say if no be football dem dey tok about, sometimes na di kontri wey dia jollof rice dey sweet pass dem go dey drag.
Di game bin Kick-off by 7:30 pm Ghana time and 8:30pm Nigeria time.
Wetin dey at stake
Na only one of dis two kontris go qualify for di FIFA World Cup for Qatar.
Since dia first World Cup appearance for 1994, Nigeria don qualify for di last six of six out of Seven World Cups, na only di 2006 edition dem don miss.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem don also reach di round of 16 three times for di World Cup.
So Nigeria wan play for pride to kontinu dia good qualification run.
Ghana qualify for dia first World Cup for 2006 and dem reach di second round.
For di 2010 Fifa World Cup for South Africa, Ghana become only di third African team to reach di World Cup quarter-finals, and for 2014, dem participate for dia third consecutive World Cup.
Ghana miss di 2018 Edition for Russia and so, dem no wan miss di 2022 Edition.
Head to Head
E don tey wey di rivalry between Ghana and Nigeria dey ground
Dis match na anoda test wey add to di statistics for history.
Wit dis match now, dem don meet 57 times for all competitions, before now, di last time dis two kontris meet, na for 2011.
Di Black Stars don win 25 while di Super Eagles don win 12 and di oda19 games end for draw. Dis one now go make am be 20.
Nigeria get small problem sake of say to play Ghana away from home no dey favour dem like dat.
Na 16 times dem don lose and six bin don end for draw. Dis wan make am seven.
As e be so, na only one time Nigeria don win out of di total 24 times wey Ghana don host.













