Lionel Messi don chop three months ban

Messi dey collect red card

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Messi and Argentina don dey para on top Copa America waka

Argentina captain Lionel Messi don chop ban from international football for three months afta e tok say Copa America dey "corrupt".

Di Barcelona striker chop red card for Argentina match wey dem win 2-1 against Chile for di third place, and later im tok say, "dem rig di cup for Brazil".

Messi get seven days to appeal Conmebol decision to suspend am.

But until then, dis ban mean say Messi go miss Argentina friendlies against Chile, Mexico and Germany wey go hold for September and October.

Argentina go start dia campaign to qualify for di 2022 World Cup for March 2020.

Afta Brazil flog Argentina 2-0 for di semi-finals, di Argentine Football Association start to hala about wetin dem call "serious and gross refereeing errors".

Conmebol come ansa say di claim no get evidence and show say dem no get respect.

Messi tok say "We no need to dey part of dis corruption. Dem no show us respect through out di competition come make pipo no dey enjoy football."

Dis bin come afta im get red card on top gbege with Gary Medel wey dem also comot from pitch.