Luka Modric na best men footballer for di world

Modric

Wia dis foto come from, Dan Istitene

Wetin we call dis foto, Modric win Uefa Champions League wit Real Madrid and cari Croatia enta World Cup final

Luka Modric nack Mohamed Salah and Cristiano Ronado to win di best male footballer for di Best Fifa Football Awards dem do for London.

For di first time since 2016, Lionel Messi no make am for finalists.

Brazilian footballer Marta win di best female footballer for di award.

Mohammed Salah win di Fifa Puskas goal of di year. Im goal for Liverpool against Everton, na im fans vote pass.

France Didier Deschamps win di award for di best men coach for 2018.

Former Chelsea goalkeeper Thibaut Courtois na im den announce as di best goalkeeper.

World eleven

British actor Idris Elba and French journalist Anne-Laure Bonnet host di show for di Royal Festival Hall, wey start by 8:30 pm Nigerian time.

Dis na di third year of di Best Fifa awards afta di world football joinbodi end dia arrangement with Ballon d'Or wey last for six years.

Sergio Ramos and im wife

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Many celebrities and player come di event with dia family