Nigeria v Liberia: George Weah dey use di presidency do play-play?

Wia dis foto come from, EPA
Nigeria friendly match against Liberia on Tuesday for Monrovia suppose to honour di kontri president George Weah but football fans shock well-well to see am play.
Weah play 79 minutes for di Lone Stars, for match wey dem lose 2-1 to Super Eagles before im comot for field.
Nigeria Henry Onyekuru and Simeon Nwankwo score di goals for di Super Eagles before Kpah Sherman score di Lone Stars only goal.
Liberia organise di friendly to retire di number 14 jersey wey di presido bin wear during im football days, but fans bin no expect to see am wear di same jersey 16 years afta im last play for im kontri.
Weah enjoy successful career for Europe. Till now na im be di only African player to win World Footballer of di Year award for 1995, and also win di Ballon d'Or too.
George Weah dey use di presidency do play-play?

Wia dis foto come from, EPA
Since George Weah enta office for January dis year as President of Liberia, im neva forget im football family.
For August Presido Weah give di kontri highest national award to im former coach Arsene Wenger wen im give am di Knight Grand Commander of di Humane Order of African Redemption for im service to African Football.
Dat move pain opposition politicians for di kontri. One of dem Darius Dillion say Weah dey use im position as presido to give Liberia highest national honour to pipo wey help im ''personal life''.
End of Di one wey oda users dey read well well
Many pipo wonda wetin Arsene Wenger as pesin don do for Liberia as kontri, wey make di president go cari national award give am.

Wia dis foto come from, AHMED JALLANZO
Di latest one wey dey football fans mouth na sake of say im play for international match between two kontris, wen im don retire 16 years ago.
Some football fans especially Nigerians vex for social media say im reduce di Grade A international friendly match to common testimonial.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2

End of X post, 3