Samuel Inkoom marry wen im be 16 years?

Samuel Inkoom

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Samuel Inkoom don play 46 times for Ghana national team
Read am in 1 mins

Ghanaian footballer, Samuel Inkoom post for Instagram dey confuse pipo with di maths wey dey inside.

On Wednesday, im celebrate im anniversary with im wife, Omega Inkoom on top Instagram wia im write say "Happy 12 years Anniversary to us...".

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Social media start to dey react to di mata wen dem check im age on top di FIFA website wey show say dem born am for 1989 wey go make am 28 at di time di tori dey drop.

Some pipo sef dey think weda di anniversary e dey celebrate na wen dem start to dey date or maybe as odas dey tink, 28 years na im football age.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

If di post na for wen im marry im wife, e mean say di Ghanaian international footballer marry im wife wen im be 16 years, just some days before im turn 17.

Inkoom start to dey play for Ghana for 2008 wen im enta di U-20 World Cup team.

Im recently collect Fifa ban for one year on top say im no gree pay im agent wey im bin cheat for 2014.

Di last time wey im play for Black Stars na for one friendly match against Netherlands to prepare di team for di 2010 World Cup for South Africa.