Afghanistan: Taliban say dem don claim control of holdout Afghan valley

Taliban tok-tok person

Wia dis foto come from, @seckermani

Taliban tok-tok person Zabihullah Mujahid don claim say di group don take control of Panjshir province.

Di valley "don dey been cleared today completely", e tok fornews conference in Kabul.

Di story of Afghanistan 'undefeated' valley

As we bin dey yarn, e get one competing claim say resistance fighters deny di Taliban claims say dia fighter don seize Panjshir. Here na wetin you need to know about di area.

Panjshir, na one rugged mountain valley, na home to between 150,000 and 200,000 pipo. Di place bi centre of resistance when Afghanistan dey under Soviet occupation in di 1980s and during di Taliban previous period of rule, between 1996 and 2001.

Di long, deep and dusty valley stretch reach about 75 miles (120km) - south-west to north-east - to di north of di Afghan capital Kabul.

Di place dey protected by high mountain peaks - rising 9,800ft (3,000m) above di valley floor. Dey be one imposing natural barrier - protection for di pipo wey dey live there.

E get only one narrow road in, wey wind im way between large rocky outcrops and di meandering Panjshir River.

"E get one mythical aspect to di entire area. No be just one valley. Once you get into it e get at least anoda 21 sub valleys connected," Shakib Sharifi wey bin live there as pikin tok e comot Afghanistan after di Taliban take control.

At di far end of di main valley, one trail lead up to di 4,430m (14,534ft) Anjoman Pass and head further east into di Hindu Kush mountains. Di armies of Alexander di Great and Tamerlane - di last of di great nomadic conquerors of Central Asia - both pass dis way.

Panjshir

Wia dis foto come from, AFP

Panjshir leaders 'missing'

Di Taliban say di pipo wey dey in control of Panjshir dey "miss at di moment".

Di tok-tok peron say Afghanistan na dia home, and dem fit return if dey want.

E add say weapon wey dem seize from Panjshir go dey added to Afghanistan weapons cache.

Taliban supreme leader 'go soon come into public view'

Di Taliban tok-tok pesin say di group supreme leader, Hibatullah Akhundzada, dey alive and "and go soon come into public view".

Questions bin dey raise about wia e dey and why e never show face for public so far.

Akhundzada become di supreme commander of di Taliban in May 2016.

Im age go dey around 60 and e bin live most of im life in Afghanistan.

According to sabi pipo, e maintain close tie wit di so-called "Quetta Shura" di Afghan Taliban leader wey base for Pakistani city of Quetta.

As di group supreme commander, Akhundzada dey in charge of political, military and religious affairs.

soldiers tanda for road

Wia dis foto come from, EPA

Taliban spokesman addresses issues at border crossings

Di Taliban tok-tok person note say dem bin get particular issues say Afghans dey try enter Pakistan via di Chaman and Torkham border crossings.

E say di Taliban don consistently order say make dia fighters no block access to di crossings.

But e add say one recent delegation to Kabul say di crossings dey closed sake of security concerns wey dem link to release of prisoners inside Afghanistan, and request make dem dey check pipo wey dey try enter or leave di kontri.