Ondo Election Update: Independent National Electoral Commission rules voters, candidates must follow on 10 October

Wia dis foto come from, INEC
Nigeria election office, Independent National Electoral Commission (INEC) don announce rules voters must obey during 10 October Ondo State Governorship election
INEC don draw ear give pipo wey wan comot to vote for election wey go happun on Saturday say dem no go allow pipo wey no wear face mask to join di queue to vote sake of Coronavirus Pandemic.
Oda tins wey Ondo state INEC REC, Rufus Akejuof tok as wetin voters no fit do na:
Vote buying no longer be joke
He tok say dem go arrest pipo wey do am immediately
"Vote buying no longer be joke". He tok
Voters no go fit take pictures of dia votes
E tok say INEC no go allow voters to hold dia phone near di polling booth.
Voters no go fit join queue by 2:30pm
Except for pipo wey don already get accreditation, INEC say dem no go allow pipo to join di queue fresh by dat time of di afternoon.
Dem also encourage make pipo come in large numbers to vote.
End of Di one wey oda users dey read well well











