Venezuelan Nobel Peace Prize winner carry her medal present to Trump
- Author, Max Matza
- Read am in 5 mins
Di Venezuelan opposition leader María Corina Machado carry her Nobel Peace Prize go give President Donald Trump for meeting for di White House. She tok say na to torchlight im commitment to her kontri freedom.
Afta she bin meet Trump face to face for di first time, she say "I tink say dis na historic day for us wey be Venezuelans".
Dis dey come weeks afta US forces go seize di Venezuelan President Nicolás Maduro for Caracas and charge am wit drug trafficking case.
Trump bin tell her thank you for social media post wia e bin call di move say na "ogbonge sign of mutual respect".
But di US President no gree endorse Machado as Venezuela new leader even though her movement claim victory for di 2024 elections we be bin dey widely contested.
Instead, Trump don dey deal wit di acting head of state of Venezuela, Delcy Rodriguez wey be Maduro former vice-president.
But e tok say im meeting wit Machado na "great honour" as im call her "ogbonge woman wey don go through so much".
Afta she comot di White House, Machado follow supporters wey gada outside di gates tok for Spanish, according to di Associated Press say "we fit count on President Trump".
Machado later tell tori pipo for English say "I present di president of di United States wit di medal of di Nobel Peace Prize."

Wia dis foto come from, Reuters/White House
Trump, wey don dey tok about how im wan win di Nobel Peace Prize, bin vex say dem carry am give Machado and she accept am last year.
Di BBC don reach out to di White House for comment.
Machado bin tok last week say she go share am wit Trump but di Nobel Committee later clear di air say no be so dem dey do am.
Di committee tok for statement last week say, "once Nobel Proze dey announced. E no fit dey cancelled, shared or transferred to odas. DI decision dey final and go stand for all time".
Wen BBC ask abou wetin dem get to tok on top Machado comments, di committee point BBC go dia last statement on di mata.
Bifor di White House meeting on Thursday, di Nobel Peace Center pos for X say "medal fit change owners, but di title of Nobel Peace Prize Laureate no fit".
For her tok-tok, Machafo describe how Marquis de Lafayette, wey fight for di American Revolutionary War carry medal wey get George Washington face give Simon Bolivar wey be one of di founding fathers of modern Venezuela.
Di gift bin dey as "sign of brotherhood" between her kontri and di US "for dia fight for freedom against tyranny", na so Machado tok am.
She add say, "And 200 years for history, di pipo of Bolivar don give back to di heir of Washington a medal, but dis time na medal of di Nobel Peace Prize, as recognition of im unique commitment wit our freedom".

Wia dis foto come from, Reuters
Machado also go visit di Congress to meet US senator for her visit for Washington. But tori pipo no really hear wetin she tok like dat sake of say supporters wey bin dey wave di Venezuelan flags just dey hala "María, presidente" up and down.
Machado dey expected to use her time wit Trump to try reason wit am say to back Rodríguez for now govment na mistake and say make her opposition coalition dey in charge for dis transition.
White House Press Secretary Karoline Leavitt tell tori pipo say di meetinf bin still dey go on on THursday and say Machado na "remarkable and brave voice for plenti pipo for Venezuela", She also say Trump "bin dey look forard to dis meeting and dey expect frank and positive tok-tok" about how life be for Venezuela presently.
Trump don call Machado bifor say she be "freedom fighter", but no gree to di viewpoint to appoint am to lead Venezuela afta dem comot Maduro say she no get enough local support.
Since dem gbab Maduro for 3 January, di Trump administration don sharparly move to rearrange Venezuela oil sector wey don dey under US sanctions. On Wdnesday one American official say di US don complete dia first sale of Venezuelan oil wey dem value at $500m (£373m).
Oil tankers wey de suspected say dem dey carry sanctioned Venezuelan oil din dey seized by di US as di US forces say dem don enta dia sixth tanker on Thursday.
Venezuelan goment envoy dey expected to travel enta Washington on Thursday to meet US officials and take initial steps to reopening di kontri embassy, na so di New York Times report.
Tori be say di emissary na padi-padi of Rodríguez wey don dey described as "extremely co-operative" by di White House.
Rodriguez bin deliver di yearly Message to di Nation speech for Caracas on Thursday, wia she tok say she go dey willing to attend meetings for Washington as well.
She tok say, "if I eva enta Washington as acting president. I go stand tall, walking and not crawling". As she ask di kontri make dem "no fear diplomacy" for di US.
Trump and Rodríguez also tok for phone on Wednesday. For dia Trump describe her for social media say she be "terrific pesin". Rodríguez say di call productive and courteous" wey bin dey full of "mutual respect."









