President Buhari don land London for UK-Africa Investment Summit

Wia dis foto come from, Bashir Ahmad
Nigeria president Muhammau Buhari dey London to follow participate for di inaugural UK-Africa Investment Summit.
Di summit wey go happun on 20 January, na Oga Buhari first international waka for di year 2020.
British Prime Minister Boris Johnson na im dey host di meeting wey dem dey expect go bring togeda African leaders plus international business ogas dem.

Wia dis foto come from, Bashir Ahmad
Di President go also follow meet wit di Head of Commonwealth, Prince Charles for Glasgow, Scotland.
Di hope be say dem go fit create new business opportunities wey go deliver more investments and jobs wey go benefit both Africa kontris and UK.








