Nick Imudia: Who be di former Konga boss wey die?

Wia dis foto come from, Nick Imudia/LinkedIn
Di Lagos State police command don confirm di death of Nick Imudia, one businessman and entrepreneur wey don be oga for some top-top companies for Nigeria.
Imudia dey most popular as di former oga kpatakpata for Konga Group we get one of di most popular online shopping platforms for Nigeria.
Benjamin Hundeyin, di tok tok pesin for di Nigeria Police, Lagos State, confirm to BBC Pidgin through a short phone call on Thursday say, "e dey confirmed, we get report of di incident."
Circumstances surrounding im death no dey clear yet as family never come out to confirm and police too no provide details.
But local media dey report say e die inside one accident for im house for Lekki on Tuesday, June 25.
Who be Nick Imudia?
For im LinkedIn account, Nick Imudia describe imsef as "a results-oriented professional wey get passion for driving business growth".
Imudia get B.Eng for Industrial Management, M.En for Oil and Gas Technology Management, and MBA for International Business Management.
E work for Nokia for more dan 17 years, and rise to di position of GM/MD for West and Central Africa.
End of Di one wey oda users dey read well well
Imudia don also work as Managing Director, West & Central Africa for TCL/Alcatel, one mobile phone manufacturer wey base for Hong Kong. And im current work before im death na as di CEO for d.light, wey be international energy transformation company.
Nick wit im brothers Martins and Anthony Imudia, setup di Imudia Foundation in honour of im Papa wey die in 2011. Di foundation dey help poor pipo from im community in Ika South, Delta State in areas of health and education.
Tori be say oga Nick Imudia get one daughter from im previous marriage wey later end for divorce.
Although circumstances around im death never dey made public by authorities, Nick Imudia death don bring up di issue of depression especially among wealthy and influential pipo. Di topic dey among di top trends on X for Nigeria dis Thursday morning.











