'Wen di time come, e don come' - Video show Mr Ibu for im last moments

Nigerian actor Mr Ibu

Wia dis foto come from, Mr Ibu/Instagram

Wetin we call dis foto, John Okafor dey popular for im comedy roles for inside career wey last more dan twenty years

One video wey capture one of di last moments of veteran Nollywood actor, John Okafor, wey pipo sabi as Mr Ibu don surface on social media.

Mr Ibu die on Saturday, 2 March afta long battle wit sickness.

Di one minute video wey dey trend show di late actor on top im sick bed dey praise one popular Nigerian afrobeat singer, Paul Okoye aka Rudeboy, for im support.

For inside di video, e tok say. “Rudeboy, I no know wia to start my language. But everything dey happun exactly on God’s own time. Wen di time come, e don come.

“Rudeboy, if you no make heaven, call me nama [meat]. You go enta heaven and we go siddon for di presence of di angels and chop togeda.

“Wetin pipo go dey tok about today go be, how come? But Ibu and P-Square, dem no come from di same parents."

Di singer wey share di video on im Instagram page tok say “Dis break my heart di more”.

Earlier, Oga Okoye bin post say e sleep for hospital for several weeks just to dey dia wit Oga Ibu and e still go.

“I sleep for hospital wit you for several weeks just to dey dia wit you and all… and you still leave.

Di President of di Actors Guild of Nigeria Emeka Rollas tok say Mr Ibu bin suffer cardiac arrest for 24 years, e quote Don Niwuzor, Oga Ibu manager.

Mr Ibu die at di age of 62 for one undisclosed hospital for Lagos state, Nigeria, according to local reports.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

Di actor health issues bin first come to public attention last October, wen di family post one video on social media of di Nollywood star dey celebrate for hospital.

For di video, e ask im fans for help wit medical bills, and many Nigerians turn up to support am.

Dem amputate one of im legs for November 2023 afta fans donate to one crowd-funding scheme for im medical bills.

Funds for im treatment bin cause gbasgbos between im family members as tori spread say im son Daniel Okafor and adopted daughter Jasmine Chioma embezzle di money.

Police bin arrest dem for January on top accuse say dem hack di phone of Mr Ibu and take $60,700 (£47,800) for themselves.

But Jasmine for one recent interview wit one media personal Chude Jidenwo deny di accuse say she kolobi di money for di actor treatment. She tok say she no get access to di money.

“No be true say I take money from dat family, not even once and dem no say I no get access to dat money. Di son don go police station to clear my name. Na me dey in charge of my father transaction, na me dey do di transaction before e sick, all of a sudden now, donation dey come in, you wan make I give you di phone, my papa give me.”

Di two dey expected to appear in court on 11 March for di next hearing.

Oga Okafor rise to fame 20 years ago for one Nigerian comedy Mr Ibu – wey become im nickname.

E dey regarded as one of di best Nigerian performances for comedy role.

E feature for more dan 200 Nollywood films - including Keziah, 9 Wives plus several Mr Ibu series.

Di star bin tell one local newspaper a few years ago say im get a total of 13 children some of whom e adopt.

Sisi Quadri

Nigerians bin dey in shock afta tori of di death of one Yoruba Nollywood actor, Tolani Quadri Oyebamiji, wey pipo sabi as Sisi Quadri break.

Di Chairman of di Theatre Arts and Movie Practitioners Association of Nigeria (TAMPAN), Bolaji Amusan, wey dey popularly known as Mr Latin, confam di death of Sisi Quadri on Friday, 1 March.

Sisi Quadri dey well-known for im comic style of acting in movies esepcially for di Yoruba industry.

E die a day before dem announce di death of Mr Ibu.

Olofa Ina

For January 4, local media bin report di death of popular veteran Yoruba filmmaker and actor, Chief Adedeji Aderemi, wey pipo sabi as Olofa Ina.

Di 73-year-old actor, for im lifetime, dey popular for im contemporary Yoruba theatre industry.

Fellow actor, Saidi Balogun announce im death, via im Instagram handle (@SaidiBalogun), on Thursday night.

E bin post Olofa Ina picture wit one caption “Goodnight legend Chief Deji Akinremi (Olofa Ina) RIP.”

Murphy Afolabi

On di 14th May, Nollywood actor, Murphy Alabi die one week afta im 49th birthday.

Murphy Afolabi na popular actor, director producer. E dey popular for Yoruba feems and don feature for plenty movies wey include Okiki Oru, Blackout, Queen Lateefah, Four Lions, One Blood, among odas.

Cynthia Okereke

For July 2023, di family of ogbonge Nollywood actress Cynthia Okereke confam to BBC di sad news say di actress die on Wednesday morning afta a “brief sickness.”

She die at di age of 63.

Di news of her death dey come afta tori say she bin experience kidnapping for 2022 wen some jaguda pipo kidnap her and some oda actors for Enugu.