Haiti gangs attack police stations, cause serious kasala as tension kontinu to rise

Pipo run comot dia homes hold dia belongings to escape gang violence, as Haiti kontinu for state of emergency, for Port-au-Prince, Haiti March 6, 2024.

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, More dan 15,000 pipo don run comot dia homes for di last week sake of di gbege

Gangs wey dey push say make Haiti Prime Minister Ariel Henry comot don dey set fire to police stations for di capital, Port-au-Prince.

Di police station wey dey located for di busy Salomon market na di latest to dey targeted, according to tori pipo.

Di three-day state of emergency now don dey extended by one month.

Di gangs for di city bin step up dia attacks wen Oga Henry bin leave for one regional summit last week.

Di kasala don paralyse air traffic, wey don delay im return.

Oga Henry bin try fly back to Port-au-Prince on Tuesday but end up for di US territory of Puerto Rico instead.

E no fit land for di Haitian capital sake of di international airport dey closed as soldiers stop attempts by gunmen to seize am.

Civil aviation authorities for di neighbouring Dominican Republic also turn di prime minister plane away, say dey neva dey provided wit di necessary flight plan.

Oga Henry neva give any public statements since e visit Kenya, wia e bin dey try save one deal for di African kontri to lead one multi-national force to help restore order for Haiti.

Di two leaders bin sign joint agreement wey make dem send 2,000 Kenyan police officers to Haiti but one Kenyan opposition politician tok say e go challenge di deal for court.

Meanwhile, some Kenyan police officers wey bin volunteer for di deployment don escape for dia safety.

One officer bin tell BBC say no clear device on how dey need work while on di mission. Anoda one tok say some members of im squad don withdraw following di recent rise in violence.

Gangs for Port-au-Prince don take advantage of Prime Minister Ariel Henry absence to unleash different co-ordinated attacks.

Among dia targets na di airport – wey dey wan kontrol to stop Oga Henry so e no go fly back in - and two prisons, from wia dey bin free thousands of inmates.

Dey don also set di peace court for Croix-des-Bouquets on fire and loot or torch more dan 20 oda buildings, according to one tally wey dey compiled by di National Human Rights Defense Network (RNDDH).

At least six police officers don die while di National Police Academy don also dey destroyed.

Dem also leave bodi of some prisoners on di streets afta dey don storm di National Penitentiary.

Di gbege don cause Haiti humanitarian crisis to get worse even further.

How 4,000 prisoners escape for latest violence in Haiti jailbreak

One man dey ride past burning barricade during a protest against Prime Minister Ariel Henry'goment

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Di capital Port-au-Prince don dey gbege for months now

Di goment of Haiti don declare 72-hour state of emergency on Sunday afta armed gangs storm one major Port-au-Prince prison, wey cause make at least 12 pipo die and di escape of around 4,000 inmates.

Gang leaders tok say dey wan force make Prime Minister Ariel Henry, wey currently abroad dey abroad to resign.

Di groups dey aim to comot im control of around 80% of Port-au-Prince.

Violent gang wars don kill thousands for di kontri since 2020.

One goment statement say two prisons - one for di capital and di oda for nearby Croix des Bouquets - face attack over di weekend.

E say di acts of "disobedience" be threat to national security and say dem dey sama immediate night-time curfew as response, wey start for 20:00 local time (1:00 GMT on Monday).

Among those wey dem detain for Port-au-Prince na gang members wey get connect wit di 2021 killing of President Jovenel Moïse.

According to French newspaper Le Monde, one AFP tori pesin wey bin visit di prison for Port-au-Prince bin see around ten bodies, some wit signs of injuries by bullets. E tok say di door to di prison bin dey open and e also get "almost no one" around.

Di latest rise for violence bin start on Thursday, wen di prime minister travel to Nairobi to discuss how dem go send one Kenyan-led multinational security force to Haiti.

Gang leader Jimmy Chérizier (nickname "Barbecue") declare one co-ordinated attack to remove am.

"All of us, di armed groups for di provincial towns and di armed groups for di capital, dey united," di former police officer, wey dem think say dey behind different massacres for Port-au-Prince tok.

Haiti police union bin don ask di military to help reinforce di capital main prison, but di attackers storm di compound on Saturday.

On Sunday, di doors of di prison bin still dey open and no signs of officers dey, Reuters tori pipo tok.

One volunteer prison worker bin tell Reuters tori pipo say 99 prisoners - including former Colombian soldiers wey dey jail sake of President Moïse murder - bin choose to remain for dia cells sake of fear say dem fit die for di crossfire.

Violence don dey common since President Moïse assassination for im home for 2021. E neva dey replaced and elections neva hold since 2016.

Under one political deal, elections suppose hold and di unelected Oga Henry dey due to stand down by 7 February, but e no happun.

Oga Henry bin argue say na how gang violence dey get worse make am impossible to make sure say free and fair election happun last year.

Haiti neva get one single goment official wey dem elect since di term of di last elected senators expire for January 2023 - one consequence of how dem fail to hold not only presidential but also legislative elections.

Claude Joseph - wey bin dey serve as acting prime minister wen President Moïse dey assassinated and wey now be head of di opposition party "Those wey dey Committed to Development" - tell BBC say, Haiti na one kontri e "dey on im own".

"Di goment no dey able to govern. Di prime minister, di de facto prime minister dey absent," e tok.

"Di problem na to change dat leadership and get better leadership wey fit lead to security, constitutions for election. Dat na wetin Haitian pipo dey ask right now."

For January, UN tok say more dan 8,400 pipo be victims of Haiti gang violence last year, including killings, injuries and kidnappings - more dan double of di numbers of 2022.

Anger sake of di shocking levels of violence, on top of di political vacuum, don lead to different demonstrations against di goment, wit protesters wey dey demand make di prime minister resign.

Oga Henry bin dey Kenya last week to sign one agreement to deploy 1,000 Kenyan police officers to Haiti, as part of one international mission to restore order to di kontri wey UN back.