Crowd hala as dem carry ogbonge Russian opposition leader Alexei Navalny body for burial

Collage fotos from Navalny burial

Wia dis foto come from, Getty Images

Heavy crowd gada for Moscow to mourn Russia most significant opposition leader for di past decade, Alexei Navalny, as dem carry im body for burial.

Navalny bin die for prison inside di Arctic Circle, di prison service confam.

Dem see Navalny as di most vocal critic of President Vladimir Putin. E bin dey serve 19-year jail term for offences many pipo consider as politically motivated.

Di 47-year-old blogger - wey survive poisoning wit one nerve agent - die as e dey serve long prison sentence for February 2024, afta more dan three years for detention.

Dem cover Navalny body with red and white roses

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Dem no too allow cameras to film di funeral service inside church

How Alexei Navalny burial happun

Large crowd bin gada outside of di Church of di Icon of Our Lady Quench My Sorrow inside Moscow for di funeral of Russian opposition leader Alexei Navalny.

Wen im coffin bin arrive, crowd begin hala im name.

Navalny mama, Lyudmila, dey present as di crying crowd dey outside di church to greet her shortly afta di funeral service bin end.

Dem no too allow cameras to film di funeral service inside di church but some social media pictures show Navalny for open casket and na like di Russian Orthodox tradition wia pipo go fit see and touch di face of di deceased.

Dem cover im body with red and white roses- and pipo bin surround am- including im mama, Lyudmila, and im papa Anatoliy - holding candles.

Alexei Navalny parents, Anatoliy and Liudmila bin walk to attend di funeral service of dia son for church.

None of dem bin make any public comment bifor dem enter di church.

Na black van bin carry di body of Navalny come di church as di crowd bin dey clap and shout im name wit a long line of pipo wey dey hold flowers and candles.

Odas gather for di streets, some standing on a high point near a supermarket.

Na Hundreds and possibly thousands of pipo bin turn up say goodbye to di late Russian opposition leader.

Dis na act of bravery sake of say hundreds dey detained earlier wen dem announce Navalny death two weeks ago.

Pipo wey dey cry for Moscow dey aware of di possibility of being arrested and dem no carry any political slogans.

Navalny papa and mama for di burial

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Navalny mama and papa attend di burial

More fotos from di burial

Navalny coffin arrive wit crowds wey dey shout im name

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Navalny body enta di cemetery
Fotos from di event

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Navalny wife Yulia and two children dey live abroad
Pipo dey cry for Navalny burial

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Plenti pipo bin cry as di body dey enta ground
Thousands of people come to pay dia respects to Alexei Navalny

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Crowd watch as Navalny body dey go di cemetery
Crowd throw roses for floor to respect Navalny body

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Crowd throw roses for floor as di body comot church
Plenti crowd dey hala Navalny name

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Crowd gada for Moscow to see body of Navalny
Pipo surround Navalny bodi - e na Russian opposition leader

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Pipo bin surround Navalny body
Pipo carry flowers to pay respect to Navalny

Wia dis foto come from, EPA-EFE/REX/Shutterstock

Wetin we call dis foto, Pipo carry flowers to pay respect to Navalny