Tinubu write Senate to ask for approval for military intervention for Niger

Wia dis foto come from, EPA
Nigeria President Bola Tinubu don seek di support of lawmakers in di execution of one communique by di regional bloc, Ecowa bloc for im attempt resolve di political tension for Niger wia coup remove President Mohamed Bazoum.
For one letter e present to di kontri senate on Friday, President Tinubu tell di lawmakers of di closure of Nigeria land borders wit Niger.
E also tok about do di prevention of commercial flight operations into and from Niger, and a “military build-up and deployment of personnel for military intervention” to enforce compliance if di Niger coup leaders no gree reverse to democracy.
Last Sunday, Ecowas issue series of sanctions, including a 7-day ultimatum demanding di military Junta for Niger to reinstate democratically elected President Bazoum, wey di junta still dey hold.
On Friday Niger military junta announce say dem don cut diplomatic and military ties wit Nigeria, di United States, Togo and France - dia former coloniser afta failed tok-tok wit Ecowas delegation.
West African Defence chiefs dey expected to Friday, conclude a 3-day meeting for Abuja, Nigeria capital wia tok-tok dey possible military interventions in case diplomacy fail.
Niger president wey dem komot from power bin urge di US and "entire international community" to help "restore... constitutional order" afta di coup wey shele last week.
For one opinion piece for di Washington Post, President Mohamed Bazoum tok say im dey write "as hostage".
End of Di one wey oda users dey read well well
For one statement wey dem read out on national television, dem tok say di functions of di four ambassadors don dey "terminated".
Only hours before, Niger ambassador to di US, Kiari Liman-Tinguiri, tell AFP news agency say make di junta "come to reason" and "realise say dis affair no fit succeed".
Niger na significant uranium producer - fuel wey dey vital for nuclear power - and e dey on key migration route to North Africa and di Mediterranean.
For im newspaper article, Oga Bazoum warn di coup, if e succeed, go get "devastating consequences for our kontri, our region and di entire world".
"Fighting for our shared values, including democratic pluralism and respect for di rule of law, na di only way to make sustainable progress against poverty and terrorism," Oga Bazoum write.
"Di Nigerien pipo no go forget your support for dis pivotal moment for our history."
Oga Bazoum also warn about di coup leaders' link to Russia mercenary group Wagner, wey dey operate for anoda place for di region and many see dem as pipo wey dey exercise malign influence for Niger.
"Di entire central Sahel region fit fall to Russian influence via di Wagner group, wey dia brutal terrorism don dey on full display for Ukraine," Oga Bazoum write.
Many supporters of di coup for Niger don dey chant pro-Russian slogans and wearing di colours of di Russian flag.
On Thursday, thousands of pipo enta di streets of Niger capital, Niamey, for one peaceful demonstration as dem back di coup and criticise oda West African kontris wey dey impose financial and trade sanctions on Niger.
Indication no dey say Wagner dey involved for di overthrow of Oga Bazoum, according to di US - but Wagner leader reportedly describe di coup as win.
Di military takeover don dey internationally condemned, including by di EU, UN and di US.

Earlier dis week, US Secretary of State Antony Blinken speak to Oga Bazoum on di phone, and di US say dem dey committed to di restoration of Niger democratically elected goment.
Oga Bazoum, di first democratically elected president to succeed anoda for Niger, chop detention from im own guard last week. Coup leader Gen Abdourahmane Tchiani don dey installed as head of state.
Niger na key part of di African region known as di Sahel, area wey jihadists dey disturb and where military regimes dey. For recent years e don dey seen as example of relative stability, while dia neighbours Mali and Burkina Faso succumb to military coups.
Dem host French and US military bases and e dey seen as key partner for di fight against Islamist insurgents.
President Bazoum goment na partner to European kontris trying to stop di flow of migrants across di Mediterranean Sea, as im agree to take back hundreds of migrants from detention centres for Libya. E don also crack down on human traffickers.















