One study reveal why more pipo for dia early 20s dey out of work dan pipo for dia early 40s

Wia dis foto come from, Getty Images
Pipo for dia early 20's dey more likely not to work sake of say dem no well pass those wey dey dia early 40's according to wetin one report don discover.
Dis one dey "seriously different" from di past, wen e be say na as you dey grow older, e dey likely say you no go fit work sake of sickness, di Resolution Foundation tok,
Poor mental health among young pipo dey on di rise, official figures show.
Dis wan fit affect dia education and lead dem to dey get lower-paid jobs or make dem dey unemployed, di report tok.
One in 20 young pipo (5%) bin dey economically inactive sake of ill health for 2023, e tok.
According to di report, young pipo now get di poorest mental health of any age group – dis na reverse from twenty years ago wen dem dey get di lowest incidence of common mental disorders.
For 2021/22, 34% of young pipo wey dey di age of 18 to 24 bin report symptoms of mental disorder, like depression, anxiety or bipolar disorder.
For year 2000, di figure tanda for 24%.
End of Di one wey oda users dey read well well
As a result, dem prescribe more dan half a million 18 to 24 year olds wit anti-depressants for 2021-22.

Wia dis foto come from, Getty Images
Louise Murphy, one senior economist for di Resolution Foundation, say attention always dey more on mental health for higher education, but "wetin suppose worry us pass na di outcome of wen poor mental health come togeda wit poor education".
"Di economic consequences of poor mental health worse for young pipo wey no go university, as one in three young non-graduates wit common mental disorder currently no get job," she tok.
Di study discover say na young women dey affected pass, and dem dey one-and-a-half times more likely to experience poor mental health as young men (41% compared wit 26%).
Di research also find say 79% of 18 to 24 year olds wey no get work sake of ill health only get qualifications for GCSE level or below.
Dis compare wit 34% of all pipo for dat age group.
If children wey dey di age of 11 to 14 suffer poor mental health dem dey three times more likely not to pass five GCSEs including English and Maths compared wit healthy children, di report tok.
Outside di study, di Resolution Foundation, wey dey campaign for better living standards for those on low and middle incomes, dey call for better mental health support in colleges and sixth forms, and dem call for more to be done to ensure say less young pipo leave compulsory education wit low qualification levels.
Na di Resolution Foundation produce di research, but na Health Foundation – one charity wey tok say dem dey aim to bring about better health and care, dey fund am.
Di director of di Health Foundation, Jo Bibby, tok say di "building blocks of health" na tins like "good employment and education" and "cross-government action" dey needed to stop di creation of a "lost generation" sake of poor mental health.
Dem base many of di findings on di Labour Force Survey, wey di Office for National Statistics recently stop because di number of di pipo wey dey take part inside don drop.
However, di Health Foundation bin previously tok say dem believe say di data still dey accurate enough for dia analysis.











