Kanye West wife 'naked' dress for di 2025 Grammys cause controversy

Wia dis foto come from, Getty Images
American rapper Kanye West return to di Grammys on Sunday, after ten years and im return don cause controversy.
Di two wey attend di 67the Grammy Award ceremony wey happun for di Crypto.com Arena for Los Angeles, cause tok-tok for di red carpet and 'disappear'.
Dis na as Kanye West wife Bianca Censori take off her coat to reveal one transparent underwear wey reveal her complete nakedness as she pose togeda with am for di red carpet before dem comot di event.
Censori cause sensation with di photographers and odas for di Red carpet as she bin first turn back, remove di coat, show her naked back view before she turn front and show her naked front view.
Meanwhile, Kanye bin wear all black and black sunglasses.
After di red carpet appearance, nobody see West and Censori inside di venue.
Reports begin dey fly say dem kick dem out of di event. However, anoda report say no be "true" and say West simply "walk di carpet, enter im car and leave."

Wia dis foto come from, Getty Images
Who be Bianca Censori?

Wia dis foto come from, Getty Images
Dem born Bianca Censori for Melbourne in Australia on 5 January 1995.
Di 30-year-old attend Carey Baptist Grammar School and University of Melbourne for her Bachelor in Architecture (BArch) degree from 2013 to 2017.
She also complete her Master in Architecture (MArch) from di same university for 2020, according to her LinkedIn profile .
She don work as designer for Yeezy brand since November 2020 and her interior designs dey popular for Australia.

Wia dis foto come from, Getty Images
Meanwhile Kanye West, na popular American rapper wey marry Bianca Cesori, for 2023 afta im divorce wit reality Tv star Kim Kardashian.
Di American rapper bin wan run for US president in 2020 as im bin get several political views about African Americans.
In 2018, e bin say "slavery na choice" dis wan vex Africa Americans
"Wen you hear about slavery for 400 years ... for 400 years? Dat one sound like a choice," Di American rapper bin tok.
Kenya West na billionaire and im get im money not just from music but from im own fashion line "Yeezy"
Di celebrity real name Kanye Omari West wey e don also come out to publicly say make pipo dey call am 'Ye" get four pikin wit im ex-wife, Kim Kardashian.
E last attend di Grammys for 2015 with di SKIMS founder.









