Mandela former negotiator fit charm Donald Trump?

South Africa president

Wia dis foto come from, AFP/GETTY

Wetin we call dis foto, Dis na President Cyril Ramaphosa im first meeting wit Trump for di White House
    • Author, Khanyisile Ngcobo
    • Role, BBC News
    • Reporting from, Johannesburg
  • Read am in 6 mins

South Africa president don face ogbonge wahala bifor – na im be di chief negotiator for Nelson Mandela im African National Congress (ANC) at di time talks dey go on to end di white-minority rule for di early 1990s.

But im meeting wey dey come happun for di White House go need all im power.

Cyril Ramaphosa wan fix im kontri relationship wit di US – na why dem go test im negotiating skills, as im go try to win Donald Trump wey be di world most powerful leader.

US President Donald Trump and im team don cover mouth about dis trip – as di White House tok tok pesin Karoline Leavitt refuse to give any gist about dis meeting.

"Wetin dey important na di trade relations – na wetin bring us here," Ramaphosa tok for Washington on Tuesday.

"We wan come from di US wit one fine trade deal. We wan make di relationship gidigba wia we wan find good relations between di two kontris."

Di two don get beef for months, as Trump bin dey tok say South Africa's Afrikaner community don dey face wetin im describe as "genocide" – im advisor Elon Musk wia dem born for South Africa, bin support dis.

Tension bin rise days afta Trump don enta office for im second term for January, when President Ramaphosa sign di law wey allow South Africa goment to collect pipo dia private land without compensation, when dem tok say dem collect di land for "di public interest."

Dis tin don dey affect di image of di biggest economy for Africa for di eyes of di Trump administration – wey already vex by di genocide case against Israel for di International Court of Justice (ICJ).

For February, di US president bin announce di suspension of "critical aid" to South Africa, wia dem offer to help members of di Afrikaner community, wia be white pipo from di early Dutch and French settlers, wia bin settle for di US as "refugees".

south africa protest

Wia dis foto come from, AFP/GETTY

Wetin we call dis foto, Di sacking of South Africa's US ambassador Ebrahim Rasool bin add to di tension between Pretoria and Washington

Dem bin sack South Africa ambassador to Washington Ebrahim Rasool in March afta im accuse Trump of "trying to project white victimhood as dog whistle."

US secretary of state Marco Rubio tok say Rasool "na politician wey dey attack pipo dia race" wey im "no longer dey welcome to our kontri."

Di arrival of di first group of Afrikaners for di US last week don scata di mata, as Trump kontinu to tok say dem dey "kill white farmers wey dem dey collect dia land" – di South Africa goment don deny dis mata.

According to ogbonge political sabi pesin for South Africa, Anthoni van Nieuwkerk, di decision by Ramaphosa to enta di White House na "high-risk strategy"

Ramaphosa tok tok pesin oga Vincent Magwenya tok di BBC say im hope say dis trip "go begin di process to fix dia relationship and start afresh."

Di South Africa delegation wey don dey go di white house go include four ogbonge cabinet ministers.

Im add say, di tins wia Ramaphosa and Trump go tok about dey likely to be about di African Growth and Opportunity Act (Agoa), wey be 25-year-old US legislation wey dey allow duty-free access to American consumers for some kind goods from Africa.

South Africa na one of di ogbonge kontris wey dey export for Agoa – wey e dey generate $2.7bn (£2bn) revenue for di year 2023, from carts, jewellery and metals wia dem dey sell.

Pipo dey worry say dem neva go renew dis deal – when e come up for review later dis year, or if dem go ahead wit di agreement, dem go add South Africa.

"For di absence of dis agreement wit Agoa, we dey ready to jaw jaw wit di Trump goment ova di new trade relationship, wey go benefit us all," oga Magwenya tok.

PRESIDENT Trump

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, US President Donald Trump and im team don cover mouth about dis trip – as di white house tok tok pesin Karoline Leavitt refuse to give any gist about dis meeting.

About wetin many pipo sabi as di bad relationship between Washington and Pretoria, im tok say South Africa don dey hope for "frank discussion about dem."

Agric minister John Steenhuisen, na part of di delegation. Im Democratic Alliance political party na part of di South Africa coalition goment wey dem don dey bash di ANC policies, wia dem tok say e dey lead to corruption.

Di ANC don deny dis mata.

About di ICJ case, wia South Africa bin dey accuse Israel for December 2023 say dem commit genocide against Palestinians for Gaza – one tori Israel don deny, oga Magwenya admit say e fit to "lead to ogbonge discussion."

"For di procedure, we no fit withdraw di mata, e still go be sometin we go drag.

"But about di humanitarian crisis – we gat agreement wit president Trump, wey we go focus on am and wetin we fit do togeda for di tins we bin gree on."

Trump bin tok say "hunger don catch plenti pipo for Gaza" afta Israel don block di humanitarian supplies.

Prof Van Nieuwkerk bin dey predict two tins – di first na "fine and cordial" tok tok about di reset wey South Africa bin dey search if "both teams don do dia homework well."

But im dey warn say "if pipo become emotional" for dis meeting and focus for di white genocide mata, tins go fit scata quick.

"If di South Africa delegation no fit convince di Trump goment of di right of South Africa to use dia own policy, for home and for di international level, den Trump go use di oval office to fire Ramaphosa.

"Di second part na di part we neva dey want."

Di sabi pesin hope say di South Africa delegation don reach di US wit wetin im describe as "correct proposal" wia im add say: "di negotiation no fit to start for di oval office, for di cameras.

For dis side, im tok say South Africa gatz sometin for dis meeting: pipo sabi Ramaphosa for im ogbonge negotiation skills.

Im sabi wey buttons im for press – di 72-year-old don already invite di US president for friendly golf during di G20 summit wia dey happun for South Africa in November.

"Whether pipo like Cyril Ramaphosa or not, we gatz acknowledge say im na one of di pipo for di transition from apartheid to democracy. Na im make tins happun sake of im personality and style," Prof Van Nieuwkerk tok.

South Africa president

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Sabi pipo bin tok say President Ramaphosa na ogbonge negotiator

Anoda sabi pesin wia base for South Africa's University of KwaZulu-Natal,Dr Lubna Nadvi, bin gree wit Prof Van Nieuwkerk.

Im say "di South African president gatz di personality to handle di mata if tins get out of hand".

"I bin expect say di face-to-face meeting go allow make di relationship become strong", she tok, wia im add say "Ramaphosa go deal wit di propaganda wia influence Trump im decision."

E dey important say Ramaphosa im team go try to get di US to "accept say South Africa na sovereign kontri wey im gatz to take im own decisions," Dr Nadvi tok.

Oga Magwenya also tok say South Africa neva go enta dat meeting on Wednesday wit "begging bowl".

"True say South Africa bin dey need access to enta one of di world's largest markets…di US also bin need certain goods from South Africa."

At di moment, South Africa bin dey export plenty minerals to di US – wia include platinum, iron and manganese, and oda precious stones, metals and fruit.

"Dis meeting dey show di beginning of di process to deal wit di current mata and to fix di diplomatic relations," im tok.

"Whether dat meeting go be positive or negative, e still go provide ogbonge opportunity to begin di road to make di relationship smooth."

Additional reporting by di BBC's Bernd Debusmann Jr for Washington DC.