Anthony Joshua driver charged to court ova fatal car crash for Nigeria - wetin be di offence

Wia dis foto come from, Adeniyi Orojo
Dem don sama four count charges against di driver wey dey involved for Anthony Joshua car crash for Nigeria, police tok.
Di Ogun State Police Command reveal say di driver wey drive di vehicle wey carry heavyweight Anthony Joshua and im oda team members don dey charged to court ova di crash.
For one statement wey di command tok-tok pesin Oluseyi Babaseyi issue, e say di 46-year-old driver, Adeniyi Kayode bin appear bifor one Magistrate court for Shagamu, Ogun state, south west Nigeria on Friday, 2 January and court don adjourn di case to 20th January.
For di crash wey happun on Monday, 29 December, 2025. two members of Anthony Joshua team bin die instantly.
According to di Director General of di National Sports Commission (NSC), Hon. Bukola Olopade di two pipo wey kpai na Joshua strength and conditioning coach, Sina Ghami and personal trainer, Kevin Latif Ayodele.
Dem also take di former heavyweight champion go hospital wit injuries afta di crash.
Oga Adeniyi appearance for court dey come days afta di Nigerian police confam to di BBC say dem don discharge am from hospital on Wednesday.
Di police say di driver don give formal statement to police, as police tok tok pesin Benjamin Hundeyin clear am say dem no declare di driver wanted, as rumour bin dey spread say police don arrest.
Police say investigations dey ongoing and dem go make di findings public wen time reach.
"We wishes to inform di general public say di driver of di Lexus SUV involved in di Anthony Joshua accident case dey charged to di Sagamu Magistrate Court today, 2nd January, 2026."
Charges against Anthony Joshua driver
Dem charge di defendant on four counts wey include dangerous driving and reckless driving.
- Dangerous driving wey lead to di death of pipo, as e dey contrary to Section 5(1) of di Federal Highway Act, Cap F: 135, Laws of the Federation of Nigeria, 2004.
- Reckless and negligent driving wey dey contrary to di same law.
- Driving witout due care and attention, wey cause bodily harm plus damage of property.
- Driving witout Valid National Driver Licence, wey dey contrary to di Federal Highway Act.
Afta di court hearing on Friday, di court order make dem grant di driver bail in di sum of ₦5,000,000 (Five Million Naira) wit two sureties.
Police say dem bin remand for custody pending wen e go meet im bail condition and cout don adjourn di case to 20 January, 2026 for trial.
On 29 December 2025, police for Nigeria bin confam say former heavyweight Boxing Champion Anthony Joshua involve for one fatal road accident wey hapun for Ogun state south west of di kontri.
Di 36-year-old be passenger for one Lexus SUV wey jam one stationary truck wey park for one major expressway for di Lagos-Ibadan express road.
For di scene, responders pronounce Ghami and Ayodele dead at the scene, while foto show as dem dey comot Joshua from di wreckage.
Di Federal Road Safety Corps, FRSC, say di accident involving di British Heavyweight boxer Anthony Joshua na "as a result of over-speeding and wrongful overtaking" according to dia preliminary report.
Ogun and Lagos state officials for statement tok say di British boxer dey "heavy hearted" ova di deaths of di two men, wey be im close friends.
Afta dem discharge am from hospital on Wednesday, Joshua bin visit di funeral home wia dem bin dey "prepare dia bodies for repatriation", di statement add.
On Monday, Eddie Hearn, wey don be Joshua promoter for more dan 10 years pay tribute to di team members.
"Rest in peace Latz and Sina," Hearn bin post on Instagram.
"Your energy and loyalty among so many oda great qualities go dey deeply missed. Praying for strength and guidance for all dia family, friends and of course AJ during dis very difficult time."









