Details of Pope Francis funeral and why e say make dem bury am outside Vatican

Wia dis foto come from, Reuters
Vatican don release di order of service ahead of di burial of Pope Francis on Saturday for St Peter's Square.
Di booklet, wey dem publish on di Vatican website, na 87 page long and e contain di service in English, Italian and Latin.
Sections also dey in several oda languages including French and Portuguese.
Thousands of mourners don queue to say final goodbye before di service go take place at 10:00 local time (09:00 BST).
Earlier, di Vatican bin announce say di Pope funeral go happun on Saturday, 26 April.
Di burial of Pope Francis go dey simpler dan those of previous popes, following instructions wey e bin set out imself.
But as a head of state and leader of more dan a billion Catholics worldwide, e go still be ogbonge ceremony and tradition.
Im death don draw famous figures, politicians, and thousands of followers to Vatican City to pay dia respects.
Francis go be di first pope since Leo XIII, wey bin die for 1903, to dey buried outside di Vatican.

Wen di funeral go start?
Archbishops and bishops go start to dey gada around 08:30 local time (07:30 BST) for di Constantine Wing, corridor wey dey adjacent to St Peter's Basilica.
At di same time, Catholic priests go congregate for St Peter's Square.
Half an hour later, at 09:00 local time, patriarchs from di Orthodox church and cardinals go congregate for Saint Sebastian Chapel, inside di basilica, wia di remains of Pope John Paul II lie.
Dem go waka inside one funeral procession wit di Pope coffin, wey don spend di last four days inside di centre of St Peter's Basilica.
Di funeral go start at 10:00 wen di coffin go dey laid in di square in front of St Peter's Basilica. Di service go dey led by di dean of di College of Cardinals, Cardinal Giovanni Battista Re.
Guests and dignitaries go dey seated closer to di basilica and coffin, with thousands of oda clergy and members of di public in and around St Peter's Square, similar to di funeral for Pope Benedict XVI wey dey shown below.

Di service go end with prayers for Pope Francis and one final commendation - concluding prayer wia di Pope go dey formally entrusted to God.
E go mark di beginning of a nine-day mourning period called Novemdiales wia dem go hold mass every day for im memory.
Who dey attend?
Officials expect at least 250,000 members of di public to attend di funeral and like 170 heads of state or government dey di guestlist.
Prince William go represent King Charles III, in continuation of wetin dem set in 2005 wen di den-Prince of Wales attend Pope John Paul II funeral on behalf of Queen Elizabeth II.
Other heads of state and royals don confam dia attendance, including US President Donald Trump, French President Emmanuel Macron, Spain King Felipe VI and Queen Letizia, and Brazil President Luiz Inácio Lula da Silva.

How to differentiate bishop from cardinal?
Hundreds of members of di clergy, with each group wey get specific dress code for di service go attend.
For bishops and archbishops, di liturgical clothes for di funeral include di alb, wey be white tunic wey a traditional cord dem call cincture go hold am togeda, di amice, one short linen cloth to cover di neck, and a red chasuble, one solemn cape, in honour of di pope. Finally, dem go wear a simple white linen or silk mitre on dia heads.
Cardinals dey wear similar clothes, but you fit know dem by dia damask pattern mitres, wey look like cream rather dan white.

Priests dey wear a simpler garment and one long scarf over dia tunic dem dey call a red stole.

Di leaders, or patriarchs, of Orthodox churches go wear dia own style of mitres, one cape wey dem call sakkos and ornate cloth wey dem call omophorion, in colours according to dia specific traditions.

How Francis change traditions?
After di service, Francis body — dressed in red chasuble and damask and golden papal mitre — go dey transported to di basilica of Santa Maria Maggiore for Rome for burial. E go become di first Pope since Leo XIII, wey die for 1903, wey go dey buried outside di Vatican.

Traditionally, di remains of di Pope go don dey enclosed a day before di funeral inside three nested coffins, made of cypress, lead, and oak.
Di cypress coffin symbolise humility and mortality; di outer oak coffin, na a sign of 'dignity and strength' and di lead coffin, na to preserve di remains and prevent tampering.
Last year, however, Pope Francis request say make dem bury am inside a simpler wooden coffin with zinc interior.
Na dis coffin pipo go see for di funeral service.

Wia dis foto come from, Getty Images
According to Monsignor Diego Ravelli, di Vatican master of liturgical ceremonies, di request emphasise "even more say di Roman Pontiff funeral na dat of a shepherd and disciple of Christ and not of a powerful man of dis world".
Why Francis choose im burial site?
Pope Francis na Jesuit - Catholic religious order of priests wey dey known for dia dedication to education and missionary work.
E be also a devotee of di Virgin Mary and so, e chose to dey buried for Santa Maria Maggiore, wey dey outside di Vatican walls for di centre of Rome.
Di church house di Salus Populi Romani, wey be Byzantine icon of di Virgin wey dey believed say na Luke the Evangelist make am and e dey used by Jesuit orders all over di world.

Wia dis foto come from, Getty Images
For im will, wey im write for 2022, Pope Francis say: "Throughout my life, and during my ministry as priest and bishop, I don always entrust myself to di Mother of Our Lord, the Blessed Virgin Mary."
"I wish my final earthly journey to end precisely for dis ancient Marian sanctuary, wia I dey always stop to pray at di beginning and end of every Apostolic Journey, confidently entrusting my intentions to di Immaculate Mother, and giving thanks for her gentle and maternal care," e write.
On im first day as Pope for 2013, Francis comot di Vatican to pray for Santa Maria Maggiore.
Seven popes dey buried inside di same basilica inside ornamented tombs, however, di Argentinian pontiff ask say make im tomb dey di side aisle, between di Pauline Chapel (Chapel of Salus Populi Romani) and di Sforza Chapel, close to one statue wey dey known as the Mary Regina Pacis (Mary, Queen of Peace).
"Near dat Queen of Peace, to whom wey I don always turn for help and whose embrace I don always find more dan a hundred times during my pontificate," e explain for im will.
Di Pope also ask say make im tomb dey for ground, simple and wit only di inscription "Franciscus", di Latin version of im chosen name.











