You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Safa president Jordaan arrested on fraud charges
- Author, Eshlin Vedan
- Role, BBC Sport Africa
- Reporting from, Johannesburg
- Read am in 4 mins
Palm Ridges Magistrate Court don grant bail of R20,000 to Safa President Danny Jordaan and im co-accused.
Jordaan dey face charges say im use Safa fund (R1.3million) to finance im personal expenses.
On Wednesday, im appear bifor di court alongside Safa CFO Gronie Hluyo and businessman Trevor Neethling.
Dem go re-appear for court on 5 December and if dem fail to appear for court, di court go issue warrant to dem and reverse di bail.
Di magistrate read out di bail conditions for di second and third applicants “You go need to make yoursef available for court appearances, you no fit go on any trip.”
Di bail condition include; submission of international passports, avoiding interaction wit witnesses and money.
“Applicant no 2 and 3, you go surrender your passport to di immigration officer for di duration of di case," di magistrate tok.
“If di need arise you go need to approach di court to consider your request, such services na for emergencies.
“Applicant one, you fit retain your passport but you must write di immigration officer about your travelling details befor 72 hours travelling."
Authorities bin arrest, South African Football Association (Safa) president, Danny Jordaan based on allegations say im use di organisation funds for personal gain.
Di kontri organised crime investigation unit, Hawks, don dey look into claims of fraud and theft for Safa between 2014 and 2018 amounting to 1.3m rand ($72,000, £57,000).
In March, Hawks raid Safa offices in Johannesburg, seize laptop, USBs, external hard drives and documents.
Jordaan allegedly hire private security company for im personal protection and public relations company witout authorisation from di Safa board.
Di 73-year-old, na key figure in bringing 2010 Fifa World Cup to South Africa and e don be Safa president since 2013, e dey wait for di outcome of im appearance for di Palm Ridge Magistrates court in Johannesburg on Wednesday.
Safa chief financial officer Gronie Hluyo and businessman Trevor Neethling appear alongside Jordaan, dem also arrest am in connection wit di case.
Jordaan reportedly file court application on Tuesday, wit affidavit denying any wrongdoing, in attempt to block im arrest by Hawks.
One Safa official tell BBC Sport Africa say im no get further details about di case.
Jordaan dey face growing criticism on di ongoing allegations of mismanagement and corruption witin South African football – but im maintained say e dey innocent and dey reportedly seek fourth term as Safa president.
Critics of Jordaan don call on am to resign, pointing to di failure of di men national team to qualify for World Cup since 2010 as well as di kontri grassroots football infrastructure wey dey collapse.
Profile of Danny Jordaan
Dem born Danny Jordaan for Port Elizabeth, and im go primary and secondary school for di city.
E hold BA degree from di university of di Western Cape and Honours degree from di University of South Africa and Education Diploma.
According to Safa, Jordaan start im professional career as lecturer for Port Elizabeth.
Im play cricket, hockey and football from 1970 to 1983. Based on im political and sport interest, e soon break racial barriers in sport for South Africa.
From 1983 to1992, Jordaan serve as leader for different football boards. Im also serve FIFA for different department as general coordinator of di World Youth Cup (FIFA Under 20 World Cup) and di FIFA Confederations Cup in 2001 and di 2002 FIFA World Cup for Korea andJapan.
Im serve as FIFA Match Commissioner for di 2006 FIFA World Cup in Germany as well as member of di FIFA World Cup Organising Committee in 2006. Jordaan serve on di Marketing and television committee of FIFA since 1998, as well, as a member of the FIFA World Cup Organising Committee for the 2010 and 2014.
For 1997, dem elect am as di Chief Executive Officer (CEO) of di South African Football Association (SAFA), wia im increase di organisation annual income from R32 million to R350 million. Im successfully lead South Africa team for di 2010 FIFA World Cup.
In 2013, Jordaan become president of Safa, wia im focus on youth development and women national football team.
Jordaan, na di president of the South African Football Association and di executive mayor of di Nelson Mandela Bay Metropolitan Municipality, wia e dey influence youth positively