Meet di main candidates for di Ondo state governorship election

    • Author, Adebola Ajayi
    • Role, Journalist
    • Reporting from, Lagos
  • Read am in 6 mins

Di Independent national electoral commission (Inec) don announce di reinstatement of Ayodele Festus Olorunfemi, as di flagbearer for Labour Party, in di Ondo state governorship election wey go hold on Saturday.

Inec sharply replace Sola Ebiseni on Friday, afta one appeal court judgment say di case wey Labour party bring against Sola and two odas dey "allowed” as dem invalidate Sola candidacy on Wednesday.

On Saturday, citizens and residents of Ondo state for Nigeria go vote for di next governor of di sate.

Eleven months afta di death of di former Governnor Rotimi Akeredolu, residents go head to di polls on Saturday, 16 November to vote.

Di Independent National Electoral Commission tok say na 2,053,061 be di number of registered voters. male voters na1,034,006 (50.36 %), while female voters na 1,034,964 (47.89 %).

Di highest demography na youths wey be 726,944 (35.41 %).

Lucky Aiyedatiwa - All Progressives Congress (APC)

Lucky Orimisan Aiyedatiwa na di Governor of Ondo state. E become governor afta di death of Governor Rotimi Akeredolu wey die in office for 2023.

Lucky Aiyedatiwa come from Obe-Nla for Ilaje Local Government Area of Ondo State. Dem born am on 12 January, 1965 into di family of oga Titus Akande and Madam Rosanah Moyebi Aiyedatiwa.

Between 1970 to 1976, Aiyedatiwa bin attend Saint Peter’s UNA (now FAC) Primary School, Obe-Nla/Obe Adun for Ilaje for im elementary education and in 1982, im go Ikosi High School, Ketu, Lagos for im secondary education.

Oga Aiyedatiwa go Lagos State College of Education (now Adeniran Ogunsanya College of Education), Ijanikin for 1986, wia e study Economics and Government and collect im Nigeria Certificate in Education (NCE).

For 2001, Oga Aiyedatiwa attend University of Ibadan for im advanced diploma in Business Administration before becoming alumnus of Lagos Business School – Pan Atlantic University, Lagos for 2009 wia e get post graduate certification for Chief Executive Education (CEP) in Business Management.

For 2013, im bag im Masters degree in Business Administration from di University of Liverpool, United Kingdom.

Afta di political fall out of Akeredolu and Alfred Agboola Ajayi for 2020, dem swear-in Akeredolu and Aiyedatiwa as governor and deputy, afta dem win di October 2020 govnorship election for Ondo state.

Upon becoming di deputy governor, Aiyedatiwa later hold office as di acting governor during di sickness of late governor Rotimi Akeredolu, wey make am travel on medical leave.

For December 2023, dem swear-in Aiyetidawa as di governor of Ondo state wen Rotimi Akeredolu pass on due to cancer.

For im political manifesto, Oga Aiyetidawa say e wan focus on security; to tighten di border, economy, agriculture, infrastructure, youth, education and women empowerment.

Agboola Ajayi - Peoples Democratic Party (PDP)

Agboola Alfred Ajayi na former deputy governor of Ondo State, during di first term tenure of late Rotimi Akeredolu. E later join Zenith Labour Party to contest during di last election but im lose di election.

Di 54-year-old na di flag bearer of di Peoples Democratic Party, for di 2024 Ondo state governorship election.

Dem born Agboola Alfred Ajayi, on 24 September 1968 for Ondo and for dia im do im primary and secondary education.

E later go Edo to study Law for Igbinedion University, Okada.

Oga Ajayi also serve as political party chairman for Social Democratic Party (SDP) in 1988 wen e bin dey 20 years.

For 2004, oga Ajayi serve as di democratically elected Chairman of Ese-Odo local goment.

For im political manifesto, Oga Ajayi say e wan focus on seven agenda points wey include; Security, Agriculture, Health, Education, Industry and Marine Economic Development, Rural Development and Environment, and Youth, Sport, Social, Women Development and Civil Service

Ayodele Festus Olorunfemi - Labour Party (LP)

Inec announce di reinstatement of, Ayodele Festus Olorunfemi, as di flagbearer for Labour Party, in di coming Ondo state govenorship election wey go hold on Sunday.

Inec sharply replace Sola Ebiseni on Thursday, afta one appeal court judgment say di case wey Labour party bring against Sola and two odas dey "allowed” as dem invalidate Sola candidancy on Wednesday.

Inside one press statement, di commission say dem dey act in accordance wit di court judgment na im make dem replace Sola Ebiseni wit Ayodele Festus Olorunfemi as di sole candidate of di Labour Party for di Ondo State governorship election.

“Dem serve di commission yesterday 14th November 2024 wit di Certified True Copy (CTC) of di judgement of di Court of Appeal wey set aside di judgement of di Federal High Court (FHC), Abuja Division.

Di 64-year-old candidate gradute from Prowess University in United States of America and im don do many research on Covid and oda infectious diseases.

For im political manifesto, Ayodele Olorunfemi, say im go pay workers 120,000 naira as di new minimum wage if dem elecxt am, as against wey tok say dem go pay 85,000 naira

However, e point to four key agenda of health, education, employment creation and massive infrastructural development wey im goment go focus on.

Abbas Mimiko - Zenith Labour Party (ZLP)

Abbas Mimiko, na di younger brother of former Governor Olusegun Mimiko.

Di medical psychiatrist, na im win di governorship ticket of Zenith Labour Party (ZLP) for di Ondo sate election.

E say e wan focus on a seven point agenda wey include: Food Security (Karije), Portable Water (Karimu),Wealth Creation, Education (Karika), Mass housing scheme (Kanile-Lona), Health (Kanilera), plus Peace and Security (Kalalaafia).

Di full list of candidates for di Ondo state governorship election according to Inec na;

  • Falaiye Abraham Ajibola - A
  • Akinuli Fred Omolere - AA
  • Ajayi Adekunle Oluwaseyi - AAC
  • Nejo Adeyemi - ADC
  • Akinnodi Ayodeji Emmanuel - ADP
  • Aiyedatiwa Lucky Orimisan - APC
  • Popoolqa Olatunji Tunde - APGA
  • Ogunfeyimi Isaac Kolawole - APM
  • Fadoju Amos Babatunde - APP
  • Ayodele Festus Olorunfemi - LP
  • Olugbemiga Omogbemi Edema - NNPP
  • Ajaunoko Funmilayo Jenyo - NRM
  • Ajayi Alfred Agboola - PDP
  • Alli Babatunde Francis - PRP
  • Akingboye Benson Bamidele - SDP
  • Adegoke Kehinde Paul - YP
  • Akinmurele John Otitoloju - YPP
  • Mimiko Olubansile Abbas - ZLP