Archbishop of Canterbury don resign ova Church abuse scandal

    • Author, Aleem Maqbool
    • Role, Religion editor
    • Author, Maia Davies
    • Role, BBC News
  • Read am in 7 mins

Di Archbishop of Canterbury don announce say im go step down from im role as di leader of di Anglican Communion.

Dis dey come afta one negative report wey show say one serious child abuser get connect wit di Church of England.

Reports comot last week say Justin Welby, wey be 68-year-old fail to act on reports of John Smyth "abhorrent" abuse of boys and young men and dem miss "several opportunities" to report di abuse to police.

For one statement Oga Welby say: "Afta I don get di gracious permission of His Majesty The King, I don decide to resign as Archbishop of Canterbury."

E add say "E dey very clear say I must take personal and institutional responsibility" for im role for di response to di abuse.

"I hope say dis decision go make am clear how seriously di Church of England understand di need for change and our profound commitment to create a safer church," e tok.

"As I step down I do so in sorrow wit all victims and survivors of abuse."

E say since di time dem publish di report into Smyts abuse , im bin feel "profound sense of shame at di historic safeguarding failures of di Church of England".

Di archbishop bin face mounting pressure to resign afta tori come out say e bin fail to act on reports of Smyth abuse of more dan 100 boys and young men.

Di report by Keith Makin bin describe Smyth "clearly sexually motivated, sadistic regime" of beatings during di 1970s and 1980s.

Smyth wey be popular barrister as well as a lay preacher - na member of di congregation wey dey preach sermons but e no dey ordained – e dey run summer camps for young Christians.

Dem accuse am of attacking up to 30 boys for im house for Winchester. Di boys e meet for di summer camps during di 1970s and 1980s.

E dey always look out for boys wey dey attend di camps plus those wey dey for leading public schools, including Winchester College. E go take dem go im house and flog dem wit garden cane for im shed.

Some of di victims gatz wear adult nappies bicos of di bleeding dem suffer sake of di beating.

Smyth later relocate go Zimbabwe and South Africa, where e dey alleged say e abuse more "young male children aged 13 to 17" about 85 to 100 of dem.

Last week report bin conclude say church leaders wey include Welby suppose report Smyth give police wen dem dey presented wit details of im abuse for 2013.

Oga Welby tok say true-true im for put more effort for di case, and add say last week, im bin consider to resign, but decide to stay for im role.

Di Makin review into Smyth case tok say dem for bring am to justice for decades of abuse bifor im death for 2018, if to say di church no cover am up and dem formally report am to authorities for 2013.

Believe dey say Smyth na di most prolific serial abuser wey dey associated wit di Church of England.

Reports dey say e don subject as many as 130 victims to traumatic physical, sexual, psychological and spiritual attacks.

Smyth abuse take place ova almost five decades and across three kontris, according to di report.

E abuse 26 to 30 boys and young men for UK for di 1970s and 1980s, according to di report.

E den relocate to Africa, wia e abuse about 85 to 100 "young male children aged 13 to 17".

Anglican priest Giles Fraser tell BBC say “clergy no get confidence on di Most Rev Justin Welby” and three members of di Church parliament – di General Synod – don start one petition wey dey call for Welby to resign on top im "failures" to report Smyth abuse.

"E dey very hard to find di words to respond adequately to wetin di report tell us,” Bishop Hartley tell BBC.

"I think rightly pipo dey ask di question ‘We fit really trust di Church of England to keep us safe?’ And I think di answer at di moment na 'no'," she tok.

Dr Hartley say e go dey hard for di Church to "kontinu to get moral voice" wen "we no fit get our own house in order wit regard to sometin as critically important".

"We dey in danger of losing complete credibility on dat front," she add.

She say oga Welby resignation no go "solve di safeguarding problem," but e go "be a very clear indication say dem don draw line, and say we must move towards independence of safeguarding".

Who be John Smyth and wetin e dey accused of

John Smyth na British barrister wey attack boys wey e meet for Christian summer camps for di 1970s and 1980s.

E be senior member of Christian charity di Iwerne Trust and believe dey say e be terrible serial abuser wey dey connected to di Church of England, according to one independent review wey dey commissioned one year aft aim death for 2018.

According to di long-awaited report - wey Keith Makin lead and publish on Thursday – Dem cover up Smyth abuse of more dan100 children and young men within di Church of England for many years.

Reports say e subject im victims to traumatic physical, sexual, psychological and spiritual attacks.

Di Iwerne Trust wey carry out dia own investigation for 1982 discover say Smyth go take pupils go im house near Winchester and flog dem wit garden cane for im shed.

E say eight of di boys bin receive a total of 14,000 lashes, while two more receive 8,000 strokes between dem ova three years.

Di charity bin call di practice "horrific" but dem no report di claims to police until 2013 - more dan 30 years later.

Now, Justin Welby bin tok say at di point, im "believe wrongly say appropriate resolution go follow".

One of Smyth victims, Bishop of Guildford Andrew Watson, bin don describe di the "painful and shocking" abuse e experience.

One report wey get full details of Smyth abuse bin dey presented to some Church leaders for 1982, but dem no report am to di police.

Di church encourage am to comot di kontri and move go Zimbabwe and later to South Africa, where e continue im abuse for years till im death for 2018.

Authorities charge Smyth wit di murder of one 16-year-old boy for one of im summer camps. E no dey convicted of di offence.

Smyth die at di age of 75 while under investigation by Hampshire Police.

For one statement, Oga Welby tok say im dey "deeply sorry say dis abuse happun" and "im dey sorry say many pipo wey dey fully aware of di abuse ova many years hide am. Plus say John Smyth bin carry out di abuse overseas and e die bifor e ever face justice".

E add say: "I no get idea or know about dis abuse bifor 2013."

Key dates for di John Smyth scandal

  • 1970s and 1980s: John Smyth physically abuse boys for Christian camps for di UK and Africa
  • 1982: Di Iwerne Trust, wey dey manage di camps, carry out investigation, and reveal claims of abuse, but dem no report am to police
  • 2013: Church of England "for di highest level" know about di allegations, Makin report tok
  • 2013: Police dey aware - Welby now tok say im "believe wrongly say appropriate resolution go follow"
  • 2016: Di Iwerne Trust report show for public
  • 2017: Channel 4 News investigation highlight di findings
  • 2018: Smyth die for Cape Town, without facing justice
  • 2019: Independent report wey dem commission wey Keith Makin lead look di way di Church take handle Smyth case
  • 7 November 2024: Makin report dey published - Justin Welby bin initially tok say im no go resign, but e change im mind days later