You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Rodri win Ballon d'Or 2024
Afta helping Manchester City win di Premier League and Spain triumph for di Euro 2024, Rodri win di Ballon d'Or.
Na Didier Drogba help am climb di stage, becos di midfielder currently dey on crutches afta e tear im ACL earlier dis season.
Rodri look very emotional as e lift im Ballon d'Or.
Despite di boycotts and controversy, pipo must remember just how good Rodri don dey over di last few of years.
Na key member of arguably di best club team and best international team in football today.
Aitana Bonmati win di women Ballon D’or for di second time.
She be Spain and Barcelona female football player.
Di 2024 Ballon d'Or happun for Paris wia dem crown di world best male and female footballers.
Organisers of di award don begin dey release ranking for di male and female categories alreadi.
For di ranking, Bukayo Saka dey 21st while Cole Palmer dey 25th wit Declan Rice for position 26th.
2024 Men Ballon d'Or ranking
1. Rodri
2. Vinicius Jr
3. Jude Bellingham
4. Dani Cavarjal
5. Erling Harland
6. Kylian Mbappe
7. Lautaro Martinez
8. Lamine Yamal
9. Toni Kroos
10. Harry Kane
11. Phil Foden
12. Florian Wirtz
13. Dani Olmo
14. Ademola Lookman
15. Nico Williams
16. Granit Xhaka
17. Federico Valverde
18. Emiliano Martinez
19. Martin Ødegaard
20. Hakan Calhanoglu
21. Bukayo Saka
22. Antonio Rudiger
23. Ruben Dias
24. William Saliba
25. Cole Palmer
26. Declan Rice
26 Vitinha
27. Alejandro Grimaldo
29. Mats Hummels
29. Artem Dovbyk
Oda awards for Ballon d’Or
- 2024 KOPA trophy winner- Lamine Yamal
- Men Club of The Year- Real Madrid
- 2024 Women Club of The Year- FC Barcelona Femeni
- 2024 Yashin trophy winner- EmIliano Martinez (best goalkeeper)
- 2024 men coach of di year- Carlo Ancelotti
- 2024 women coach of di year- Emma Hayes
- Best women footballer of di year- Aitana Bonmati
Di 2024 Ballon d'Or dey hold on Monday, wen players go gada for Paris to find out who dem go crown di world best male and female footballers.
Dis go be di first time since 2003 wen eight-time winner Lionel Messi nor five-time winner Cristiano Ronaldo no go feature on di shortlist.
Wit Karim Benzema and Luka Modric - di only oda previous recipients wey still dey play – wey dem also omit, a first-time winner dey guaranteed for di men's category.
For di women's category, Spain World Cup winner and Barcelona midfielder Aitana Bonmati dey hope to win di award for a second successive year.
Na one jury of journalists from each of di top 100 countries for di Fifa men's rankings dey vote for di men's award.
A jury of women’s journalists wey dey represent di top 50 countries for di Fifa women’s rankings go choose di winner of di women's award.
BBC Sport ask sabi pipo to predict who go come out on top.
Who go win di Men's Ballon d'Or?
Rodri na strong favourite, afta e help Manchester City to a record fourth successive Premier League title and e help Spain win di European Championship.
Im City team-mate Erling Haaland also dey in contention, and Real Madrid duo Vinicius Jr and Jude Bellingham dey expected to dey prominent afta dia La Liga-Champions League double.
European football journalist and broadcaster Mina Rzouki: "Why you go give am to Rodri?
"I understand say e don get great season and don be di difference-maker for Manchester City. But e no be di standout player for Spain.
"Vinicius Jr bin make a difference for every important match for di Champions League, so surely you suppose go for am. E be di difference between dem winning and losing.
"Rodri na just a part of a great team. Rodri deserve am last year becos na im be di difference between dem winning and losing, and I no happy as e no get am or come even come close to am.
"Dis year I go take a difference-maker and dat na Vinicius or im Real Madrid team-mate Jude Bellingham. My pick na Vinicius."
French football journalist Julien Laurens: "Kylian Mbappe na di best player for di world but I go give di Ballon d'Or to Rodri.
"Rodri dey important for im team as Vinicius Jr and Jude Bellingham dey important for dia team. Dat na wetin great players dey do.
"Rodri na di best player for di world for two seasons now. I know say e no dey for offensive position - e no dey score goals, do dribbles or tricks.
"But e be di most intelligent player for im position for di world. E dey super decisive and di last few years bin dey outstanding for club and country. E deserve di Ballon d'Or more dan anyone else."
Belgium football expert Kristof Terreur: "Dis na di end of di star era and now you get new stars wey neva really perform for di highest level. I lean towards Vinicius Jr."
Spanish football expert Guillem Balague: "Rodri don do everything e suppose do for di club and international level.
"E play di role wey no dey usually get accolades but everyone recognise di value of am.
"When Rodri bin get injury at half-time for di Euros final, di feeling for di stands, among di pundits, even di players, na 'what a gap to fill'. Dat one tell you say everyone sabi say e be di player wey dey dictate di play. Everyone dey look up to im leadership as well.
"Dis na great opportunity to give award to an unsung hero. E go dey for top three but probably e no go win am as pipo most often dey favour di players wey look good on di ball and constantly dey for di highlights for di spectacular."
Who go win di Women's Ballon d'Or?
Dem expand three of di four winners since di Ballon d'Or to recognise female footballers for 2018 wey dey di contention again.
Bonmati (2023), Spain team-mate Alexia Putellas (2021, 2022) and Norway Ada Hegerberg (2018).
Five of di United States Olympic gold medal-winning squad also dey nominated - Trinity Rodman, Mallory Swanson, Lindsey Horan, Sophia Smith and Alyssa Naeher.
Balague: "Aitana Bonmati control di game, score goals, assist, personality. She dey grow well wit a team wey don carry women football to a new dimension.
"She get di high standards any midfielder suppose aspire to, but, becos di Ballon d'Or no be just about di football, she also represent di club and national side very well.
"She be reference for kids on di stands and kids for di game. She be great representative for football."
Former England midfielder Fara Williams: "I go like see Lindsey Horan for di top five, but my favourite go be Bonmati. Na her IQ - her game understanding dey up there wit di very best.
"She dey control di midfield for Barcelona, she no just dey control am, but she dey add goals and assist to her game. When you be midfielder and you get those attributes, you be ogbonge player."
Bay FC defender Jen Beattie: "I dey go for Trinity Rodman. She don get unbelievable season. Wetin she do for di Olympics dey incredible.
"She be di perfect combination between pace and technical ability. Di speed she dey carry on top field dey incredible.
"She really deserve am. Wetin she don do for di club and for di kontri – dat na wetin go put you for di mix for Ballon d'Or. She don do everytin on all levels."
Former England forward Ellen White: "Trinity Rodman fit win am, or Sophia Smith or Aitana Bonmati.
"But I wan give shout out to Barbra Banda. She bin get amazing Olympics, plus successive hat-tricks. She be di second top goalscorer for di NWSL wit 13 goals in 20 games."
Who be di nominees for the Ballon d'Or awards?
Na 30 nominees dey for both di men and women category.
For di men’s category, six England players - captain Harry Kane, midfielders Jude Bellingham, Phil Foden and Declan Rice, and forwards Bukayo Saka and Cole Palmer – dey nominated.
England-based players Ruben Dias, Emiliano Martinez, Martin Odegaard and William Saliba also dey nominated.
Dis na di first time since 2003 wey dem no go nominate eight-time winner Messi and five-time winner Cristiano Ronaldo.
For di women’s category, England trio Lauren James, Lucy Bronze and Lauren Hemp dey up for di award.
Six more nominees dey from di Women Super League wit Chelsea duo Sjoeke Nusken and Mayra Ramirez, Manchester City's Yui Hasegawa and Khadija Shaw, and Arsenal Mariona Caldentey dey nominated.
How dem dey decide di awards?
Na one jury of journalists from each of di top 100 countries for di Fifa men world ranking dey vote for di awards.
Each juror go select 10 players in descending order of merit from di list of nominees.
Those 10 players go dey awarded 15, 12, 10, eight, seven, five, three, two and one point respectively.
Di player wey get di most points go dey awarded di Ballon d'Or.
A full list of di rankings - from 30th to second – go follow di announcement of di winner.
Who be di favourite for di men's Ballon d'Or?
Real Madrid winger Vinicius Jr na di clear frontrunner to win di award for di first time.
Di 24-year-old score 24 times and provide 11 assists for all competitions last season as Madrid win di La Liga title and a record-extending 15th Champions League.
Di Brazilian bin score for Madrid 2-0 win for di Champions League final against Borussia Dortmund for Wembley for June.
One factor wey fit count against Vinicius na im performances wit Brazil. E bin score only two times in nine appearances for im kontri dis year and no fit stop dia quarter-final exit to Uruguay for di Copa America.
Manchester City midfielder Rodri na Vinicius closest challenger.
Di 28-year-old bin dey instrumental for City Premier League title victory last season.
Dem name am player of di tournament as Spain beat England for di Euro 2024 final for June.
Vinicius Jr club team-mate Jude Bellingham also dey for di contention afta im ogbonge debut season wit Real Madrid, where e score 23 times in 42 appearances.
Who be di favourite for di women's Ballon d'Or?
Last year winner Bonmati na di clear favourite to retain her crown.
Di World Cup winner bin get anoda brilliant campaign for Barcelona, as she help her club to dia fifth straight Liga F title last term.
Bonmati bin score for Barcelona Champions League final win against Lyon for May and dem name her player of di tournament.
For international level, she don strengthen her case for di award by leading Spain to di Uefa Nations League title, and as she score for di opener in a 2-0 win against France for February.
Di main challenger for Bonmati crown na her Barcelona colleague Caroline Graham Hansen.
Di Norway winger top-score for Liga F wit 21 goals and she provide 19 assists, dem name her for di team of di tournament afta Barcelona Champions League triumph.
Oda contenders include Kadidiatou Diani, afta she bin help Lyon to di French league title, Barcelona forward and last year third-place finisher Salma Paralluelo and Chicago Red Stars forward Mallory Swanson, afta her four goals help di United States to Olympic gold for Paris.
Which oda categories dey there?
Plus di two main prizes, eight oda awards dey up for grabs.
Di Kopa Trophy, dem dey give dis award to di best player under di age of 21.
Dem dey give di Yashin Trophy for best goalkeeper.
Men coach of di year award and Women coach of di year award also dey - club or national team managers fit win dis one.
Club of di year trophy also dey for both women and men teams.
Gerd Muller trophy bin dey for di top scorer for di previous season plus one Socrates award for humanitarian work.