Wetin and wetin each team need to qualify for Afcon 2025?

Read am in 6 mins

By dis time next week we go know di 24 teams wey go contest di 2025 Africa Cup of Nations, wit di final two rounds of qualifiers set to throw up a number of winner-takes-all matches.

Ghana na di biggest name wey dey in danger of missing out for di tournament in Morocco, as di Black Stars need to pick up maximum points and hope Sudan suffer two defeats.

Di top two for each of di 12 qualifying groups progress, wit former champions Algeria, Cameroon, DR Congo, Egypt and Senegal wey already don get assurance of dia places alongside Angola, Burkina Faso and di hosts.

Central African Republic na di only side still in contention wey neva make dia Nations Cup debut, while Botswana and Rwanda dey bid to make just a second appearance.

BBC Sport Africa run di rule over who need what to clinch a place for Africa biggest sporting event, wey go begin on 21 December next year and run until 18 January 2026.

Tunisia sweat on ticket

Group A na di tightest to call, wit all four nations still in wit a shout.

Leaders Tunisia dey point ahead of Comoros and two in front of The Gambia, wit outsiders Madagascar further back.

Di Carthage Eagles, wey dey chase record-extending 17th successive appearance for di finals, don place Kais Yaacoubi in interim charge afta sacking veteran boss Faouzi Benzarti.

Madagascar must beat di North Africans on Thursday to keep dia faint hopes alive, while Di Gambia go face crunch ‘home’ clash against Comoros one day later in Berkane.

Depending on di results, di final round of matches, wen Tunisia welcome di Scorpions and Comoros entertain Madagascar, fit dey nerve-shredding for fans of all four countries.

Group B look more straightforward, wit Morocco wey don dey guarantee on di top spot and Gabon favorites fit become second.

Di Panthers host Morocco on Friday and through if they match Central African Republic’s result against Lesotho.

Odawise, Gabon visit to CAR on Monday go be anoda must-watch decider.

Super Eagles on brink as Zebras chase history

Botswana dey driving seat for di one remaining berth up for grabs for Group C, as dem hold three-point lead over Cape Verde and Mauritania.

Di Zebras host Mauritania on Friday bifor Cape Verde entertain Egypt, wey rest captain Mohamed Salah.

Head-to-head record fit play out to settle tins wen Botswana travel go Egypt and Mauritania welcome Cape Verde on Tuesday.

Morena Ramoreboli na im take charge of Botswana for now, afta Didier Gomes da Rosa comot to take charge of Libya club side Al Ahli for Tripoli.

Meanwhile, Nigeria need just one point to qualify from Group D, afta dem chop award of 3-0 walkover against Libya, afta dem leave dem stranded for one airport for di kontri overnight last month – although Libya still fit appeal di mata.

One of Benin and Rwanda dey ready to join dem, as Libya dey hang for one corner, ready for elimination.

Di Mediterranean Knights must beat Rwanda and Benin plus also hope say Nigeria Super Eagles do dem favour by winning both of dia games wit di same opponents.

Qualification go go down to di final day unless Benin beat Nigeria and Rwanda fail to register victory against Libya.

Black Stars ready to comot

For Group E, Togo gatz beat Liberia wey don alreadi comot for di tournament.

If dem win Liberia for Monrovia on Wednesday, dem go fit extend dia bid to a final-day must-win showdown wit Equatorial Guinea for Lome on Sunday.

Howeva, di National Thunder fit qualify wit a game wey remain if dem beat Algeria wey dey top di table Algeria on Thursday.

Ghana hope dey hang by a line for Group F afta dem pick up just two points from four games.

Di four-time continental champions fit even dey eliminated by di time dem go play Angola for Luanda on Friday.

Sudan go progress if dem avoid defeat ‘away’ against Niger for Lome di day bifor.

Ghana final game na against Niger, but dia slim hope suffer anoda blow wen defender Alexandre Djiku and forwards Antoine Semenyo and Inaki Williams dey among eight players wey withdraw from coach Otto Addo squad, while dem no call Arsenal midfielder Thomas Partey.

Kamara back to boost Leone Stars

Group G fit see a final-day decider between Zambia and Sierra Leone, and di reigning Afcon champions Ivory Coast go also require one more win to be sure of a chance to defend dia title.

Di Leone Stars fit seize di initiative and move level on points wit Zambia if dem win ‘away’ against Chad for Abidjan on Wednesday.

Morals of di West Africans dey high by 40-year-old striker Kei Kamara - di second-highest scorer for di history of US Major League Soccer – as e come out of international retirement.

Zambia entertain di Ivorians on Friday but know say a draw from dia away match against Sierra Leone go dey enough to progress on head-to-head afta winning di first meeting between di sides.

Guinea and Tanzania dey fight ova di final spot for Group H, as di West Africans hold two-point advantage.

Guinea host DR Congo as Tanzania travel go Ethiopia, and Guinea then go to Tanzania for di final round.

Ethiopia get slim chance of qualifying, but must win both of dia games and hope Guinea lose both of dia games.

Cranes chase point

Mozambique and Mali both dey on eight points at di top of Group I, and either side go secure passage if dem win dia meeting in Maputo on Friday.

Guinea-Bissau dey four points behind and hoping to capitalise on any team wey lose, but Luis Boa-Morte men need to return from dia trip to already-eliminated Eswatini wit three points.

Guinea-Bissau host Mozambique during di final round of di match, wen Mali welcome Eswatini.

Zimbabwe dem be di hottest favourites, dem go join Cameroon in qualifying from Group J and dem go qualify if dem avoid defeat for home against Kenya in neutral Polokwane on Friday.

Di Harambee Stars must win dat game to keep dia own hopes alive, dem must do beta pass Zimbabwe result for Cameroon wen dem host Namibia on Tuesday.

In Group K, Uganda need just one point from dia two fixtures, at home against South Africa and away in Congo-Brazzaville, to return to di finals for di first time since 2019.

South Africa need one victory and dem dey confident of beating winless South Sudan for dia home next Tuesday if dem drop points in Uganda.

Congo realistically need two big wins to spoil di party.

Qualification in Group L don already dey settled, wit both Burkina Faso and Senegal through wit two games to spare at di expense of Burundi and Malawi.