You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Caf sanction Libya, award three points to Super Eagles
Di Confederation of African Football (Caf) don announce dia disciplinary decision concerning di Afcon 2025 qualifying match between Libya and Nigeria wey no hold.
Caf find say di “Libya Football Federation breach Article 31 of di African Cup of Nations Regulations as well as Articles 82 and 151 of di Caf Disciplinary Code.”
Di match wey bin suppose hold on 15 October 2024 in Benghazi no happun sake of di controversy following a 16-hour delay of di Nigerian team on arrival in Libya. Dis na afta dem divert Super Eagles flight to land in Al-Aqrab, 230km away from di match venue.
Di Super Eagles of Nigeria say dem no go play di 2025 Africa Cup of Nations qualifying match wey dem get with Libya sake of di mata.
Dis bin happun afta afta di Libyan authorities force dia flight to land for Abraq Airport instead of di Benghazi airport.
Ekong for im post for X tok say dem don wait for di airport for over 16 hours without food and drink.
Di Confederation of African Football (Caf) bin condemn how Libya take treat Nigeria National football team, Super Eagles.
Di football body say dem bin get informate say di Nigerian national team plus dia technical team bin hook for one kain gbege for very long hours afta Libyan authorities give dem instruction to land.
At dat time, Caf for statement say di matter now dey di domot of dia Disciplinary Board for investigation.
Dem add say dem go take proper action against di pipo wey violate CAF Statutes and Regulations.
As tins be now, di match now don dey forfeited by di Libyans wit Nigeria awarded three points and three goals.
Caf for dia decision order Libya Football Federation to pay a fine of $50,000, wey dem suppose “pay within 60 days of notification of di present decision.”
Di decision by Caf come few days, afta di president, Patrice Motsepe, while addressing a general congress of di football body for Addis Ababa on Tuesday, say di organisation dey committed to accountability in such matters.
Di decision effectively end Libya qualification hopes for di Afcon 2025 tournament.
Dis na becos di Mediterranean knights get just one point from four matches, while Nigeria, now get 10 points and don dey close to qualify for di football competition wey dey hold once in two years.