Tai chi fit slow Parkinson's symptoms down for many years - One study tok

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Philippa Roxby
- Role, Health reporter
Tai chi fit help slow down di symptoms of Parkinson's disease for several years, na wetin one Chinese study suggest.
Those wey dey do di martial art twice a week get few complications and better quality of life dan those wey no dey do am, na wetin di researchers tok.
Parkinson's na progressive brain disease wey dey lead to tremors and slow movement, dis sickness no get cure.
Sabi pipo say di research support previous studies wey tok about di benefits of exercise for pipo wey get Parkinson's.
Di study, na from Shanghai Jiao Tong University School of Medicine, dem monitor di health of hundreds of Parkinson's patients for up to five years.
One group wey get 147 pipo practise regular tai chi while anoda group wit 187 no do am.
Di traditional Chinese exercise dey combine slow, gentle movements wit deep breathing and relaxation.
Di charity Parkinson's UK describe tai chi as low-intensity physical activity wey fit "help to lift your mood and help you live well".
End of Di one wey oda users dey read well well
Di researchers discover say di disease progress more slowly for di tai chi group on measurements of symptoms, movement and balance.
Dis group also see fewer falls, less back pain and dizziness, wit memory and concentration problems also lower dan di oda group.
At di same time, sleep and quality of life continuously dey improve.
Tai chi moves for beginners

Do am yourself – Wit carrying di moon:
- Breathe in, turn your body to di left from your waist
- Relax your shoulders and bend your elbows slightly
- Now carry both of your arms to your left wit your head focus on your hands
- Breathe out, bring your hands down. Turn right and repeat am
Do am yourself – Twist your waist and push your palms:
- Breathe in, draw your palms to your waist and face up
- Breathe out, turn your body go left from your waist. Keep di left elbow and slightly bend your wrist and draw di elbow back
- At di same time, extend di right arm come front and push wit di right palm face forward (as if you dey try to stop traffic)
- Breathe in, return to di middle and spread your weight evenly before you turn to di right, draw your right arm back and extend your left arm wit your palm face forward.
One previous trial of pipo wit Parkinson's wey practise tai chi for six months find great improvements for dia walking, posture and balance dan those wey no do di programme.
Writing for di Journal of Neurology Neurosurgery & Psychiatry, Dr Gen Li and co-authors say dia study show " say tai chi retain di long-term beneficial effect on Parkinson's disease".
Dem say tai chi fit manage Parkinson's on a long-term basis and e fit sustain di quality of life, and help patients to dey active.
But dem also agree say di study dey relatively small and based on dat, dem no fit prove say tai chi na di reason for di positive outcomes wey one of di group experience.
'Positive effects'
Prof K Ray Chaudhuri, professor of movement disorders and neurology for King's College London, say: "E dey too early to claim any neuroprotection based on dis study, although e say di positive effects on aspects of motor and non-motor functions dey impressive."
Im say one research also say ballet find similar effects on Parkinson's.
Prof Alastair Noyce, professor in neurology and neuroepidemiology for Queen Mary University of London, call am " important study" but say limitations dey for di design, and add say dem need to do more trials.
"We already recommend tai chi, wit oda forms of exercise, but to understand which forms of exercise dey most beneficial na important goal to boost di long-term management of patients," e tok.













