How ramadan fasting fit affect insulin resistance for pipo

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Somaya Nasr
- Role, BBC News Arabic
In di past two years, plenti tok-tok for media and social media don land about "insulin resistance", Books don dey published about and videos don comot wia creators promise say dem get di exercise and diets to prevent or control am.
Dis mata don draw more attention bicos insulin resistance fit cause serious medical conditions like type 2 diabetes.
So how insulin resistance dey take happun and wetin be di symptoms? E fit dey cured? And fasting fit control am?

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin be insulin?
Insulin na sometin wey di pancreas dey make and na one of di most important hormone for bosi.
Im work na to regulate blood sugar (glucose) levels by allowing di bosi to store am and use am for energy.
Many health palava fit happun of di pancreas produce little insulin or if bodi no fit use am well-well.

Wia dis foto come from, Getty Images
Insulin dey work for bodi by say:
- Di bodi dey turn food wey you chop to glucose, wey dey seen as one of di main source of energy for bodi.
- Glucose go come go di bloodstream, wey go send sign to di pancreas to release insulin.
- Insulin dey help glucose go di blood to enta muscle, fat, and liver cells so dem go dey used for energy or store am for later.
- Wen glucose enta di boi cells and di levels for di blood reduce, dat na di sign for di pancreas to stop to dey produce insulin.

Wia dis foto come from, GETTY IMAGES / JUAN GAERTNER / SCIENCE PHOTO LIBRARY
Wetin insulin resistance mean?
Insulin resistance na one difficult process wen cells for di muscles, fat, and liver no dey ansa insulin and dem suppose to to.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis dey make dem to stop to dey take in or store glucose wella.
Di pancreas go come make more insulin to deel wit di high glucose levels for di blood, wey be condition wey dem dey call hyperinsulinemia.
As long as di pancreas fit make enough insulin to overcome di week cell response, blood sugar levels go remain within healthy range.
But if di cell resistance to insulin increase, e fit lead to high levels of glucose for di blood wey fit lead to type 2 diabetes and oda medical conditions.
Franklin Joseph na UK National Health Service consultant doctor wey dey focus for endocrinology, diabetes and internal medicine, and e be di founder of di Dr Frank Weight Loss Clinic, e say insulin resistance na "complex condition wey plenti genetic, lifestyle and environmental factors dey cause".
Di reason for am no dey di same among pipo.

Wia dis foto come from, Franklin Joseph
E say plenti reasons dey why e fit develop:
- Obesity: Excess body fat, particularly abdominal fat (also called visceral fat, wey dem see as “bad” fat), get strong link wit insulin resistance.
- Physical inactivity: Lack of regular physical activity fit contribute to insulin resistance.
- Genetics: Some pipo say e dey dia genes to get insulin resistance.
- Poor diet: Diets wey dey high for processed foods, refined carbohydrates, and sugars fit add to insulin resistance. Dis foods dem fit cause quick quick hike for blood sugar, wey go cause increase insulin production later.
- Chronic stress: Stress hormones like cortisol fit interfere wit insulin ability to regulate blood sugar levels, wey fit cause insulin resistance.
- Sleep disturbances: Lack of sleep or poor sleep quality fit affect insulin sensitivity. Sleep deprivation fit disrupt hormone levels and lead to insulin resistance.
- Certain medical conditions: Conditions like polycystic ovary syndrome (PCOS), Cushing syndrome, and fatty liver disease fit increase risk of insulin resistance.
- Ageing: As pipo dey age, dia cells fit dey less responsive to insulin, and lead to insulin resistance.

Wia dis foto come from, Getty Images
Ramadan fasting
Many Muslims dey fast from dawn to dusk for di month of Ramadan.
Di charity Diabetes UK dey draw ear give pipo wey get health issues.
Professor Wasim Hanif, Professor of Diabetes and Endocrinology and Clinical Director for Diabetes for University Hospital Birmingham say "e dey important to make sure say pipo wey get diabetes dey only fast afta dem follow tok about am wit dia diabetes doctors. Fasting fit dey dangerous if you get diabetes as e fit cause health problems."
Prof Joseph say some studies suggest say dis kain fasting fit improve insulin sensitivity, especially for pipo wey get insulin resistance and type 2 diabetes.
Some pipo fit lose weight or change for bodi fat during fasting periods. Dis changes for affect insulin sensitivity and metabolism, especially for pipo wey dey obese.
E add say di impact of fasting for Ramadan on insulin resistance and metabolism dey different for pipo "based on tins like age, gender, pre-existing health conditions, dietary habits, and physical activity levels".
"E dey important for pipo wey dey do Ramadan fasting, especially if dem get diabetes or oda metabolic conditions to monitor dia health wella and ask advice from healthcare professionals to make sure say dem dey fast safely and dey manage dia health wella for fasting period."

Wia dis foto come from, Getty Images / Nur Photo
Amman-based nutritionist Reem Al-Abdallat tok say “e dey important to get healthy eating habits weda na intermittent fasting you dey do or na Ramadan" so you go fit maximise health benefits.

Wia dis foto come from, Reem Al-Abdallat
Intermittent fasting dey good for insulin resistance sufferers?
Intermittent fasting don get ogbonge attention worldwide for di past few years and doctors and nutrition experts just dey sing di praises.
Di process na to stay away from food for longer for dat and only leave small time to chop or even go one full day without say say you chop and dem go just dey increase time without food each week.
Dr Nitin Kapoor na professor of endocrinology (wey be di study of hormone disorder like diabetes, obesity and thyroid) for di Christian Medical College University Hospital for Vellore for di Indian state of Taamil Nadu.
E say some medical papers suggest say dis kain fasting get metabolic benefits. But e warn say no be evribodi fit do am and say any diet wey dem prescribe must dey based on di patient.
E add say, "you go fit do am for life? If you wan lose15kg and wen you stop di diet e go come back wit speed."
Prof Joseph say even though research for dis kain fasting still dey change, some studies show say e fit improve insulin sensitivity.
One research from 2015 show say alternate day fasting fit boost insulin sensitivity for patients wey no dey obsese without say e affect size.
Intermittent fasting fit cause weight loss, wey dey associated wit improved insulin sensitivity and metabolism.

Wia dis foto come from, Getty Images / RichLegg
Insulin resistance symptoms
Warning signs of insulin resistance fit dey small sotay pesin fit miss am but dia be signs wey fit show say pesin get insulin resistance.
According to Prof Joseph, dem be increased hunger, fatigue, difficulty losing weight, darkened skin spots (especially around the neck, armpits or groin), high blood pressure, high triglyceride levels (bad form of cholesterol), low HDL cholesterol (the good form), and polycystic ovary syndrome (PCOS).
E add say if insulin resistance cause type 2 diabetes oda symptoms fit join like frequent urination, increased thirst and blurred vision.
Prof Joseph draw ear say di symptoms fit dey different for different pipo and no be everi pesin wey get insulin resistance go face all of dem. Di symptopms fit also mean oda health wahala. E add say to find and manage insulin resistance early dey important to prevent complications.

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin be di chance say e fit cause more serious conditions?
Studies show say about 70-80% of of pipo wey get insulin resistance dey later move on to get type 2 diabetes if dem no treat or manage am, according to Prof Joseph.
"But dat one depend on some tins like genetics, obesity, physical inactivity, diet, age and ethnicity. Some ethnic groups like di ones from south east Asia get higher risk to get type 2 diabetes pass Caucasians."

Wetin be di glycaemic system?
Di glycaemic index na system wey dem dey take class food based on how dem dey affect blood sugar levels. E dey show weda di food we dey chop fit case rapid, moderate, or slow increase in blood glucose levels.
Carbohydrates wey dey break donwm slowly dey see am as low glycaemic index, including some vegetables, fruits, unsweetened milk, legumes, wholemeal bread, and whole grain cereals. On di oda hand, sugar, sugary foods and beverages, white potatoes, and white rice na high glycaemic index foods wey dey cause rise for blood sugar.
But e dey important to note say glycaemic index by itself no reach to say one food dey healthy or not. Most chocolates for instance get low glycaemic index but get high calories. Some fruits like watermelon get high glycaemic index but dey beneficial. So, di koko suppose be to make sure say di diet dey healthy and balanced.

Wia dis foto come from, Getty Images / MartinFredy
Insulin resistance dey reversible?
“Insulin resistance fit normally dey reversed, or at least improved, wit lifestyle changes and, in some cases, medication,” na wetin Prof Joseph tok.

Wia dis foto come from, Getty Images
Nutritionist Reem Al-Abdallat advise pipo wey get insulin resistance to "pay close attention to wetin dem dey chop, as dem no suppose dey chop sweets and reduce starchy food.
Di second piece of adivice na from both Joseph and Al-Abdallat say na to maintain regular exercise.
Weight loss, especially from di fat around belle fit also improve insulin sensitivity.

Wia dis foto come from, Getty Images
Chronic stress sef dey important too, na wetin Prof Joseph tok say: “ to find healthy ways to manage stress through tins like meditation, yoga, deep breathing exercises, or spending time for nature fit help.”
To sleep wella fit dey very important.

Wia dis foto come from, Getty Images
Finally, drugs, like Metformin, dey help reduce insulin resistance and related conditions like type 2 diabetes.
Di advice na to get medical advice to know weda medication fit help.











