Champions League prediction and team news for Arsenal, Man Utd, Real Madrid and odas

Wia dis foto come from, Getty Images
Arsenal go jam Sevilla on Wednesday night for Emirate stadium for Champions League.
Di Gunners bin win Sevilla 2-1 for Spain for matchday 3.
Dis game dey come afta Arsenal bin lose 1-0 to Newcastle for Premier League for weekend.
Mikel Arteta go expect im team to collect all three points to help dem solidify dia place for di top of Group B.
For Sevilla, dem know say victory for dis game go keep dia hope of qualifying alive, as games no too plenty again for di group.
Di Spanish team dey third for di group wit two points na PSV dey carry last for Group B.
No be only dis fixture dey on Wednesday, oda ogbonge match dem dey ground too.
Our football sabi pesin go analyse some of those key games and drop im prediction for those matches dem
End of Di one wey oda users dey read well well
Arsenal vs Sevilla prediction

Wia dis foto come from, Getty Images
‘’Mikel Arteta go dey desperate for a response from im team for Emirates stadium as dem face Sevilla again.’’ Sammy Wejinya tok.
Di team bin feel bad afta Newcastle end dia unbeaten record for Premier League wit di controversial 1-0 win.
‘’I no think say Sevilla go fit stand di Arsenal pressure, based on dia form dis season’’. Wejinya add.
Di fans for Emirates go dey really gingered for dis game just like di players
Prediction: Arsenal 2-0 Sevilla
Arsenal vs Sevilla kick- off time (21:00 pm West African time)
Arsenal fit use dis line up : Raya; White, Saliba, Gabriel, Zinchenko; Havertz, Jorginho, Rice; Saka, Martinelli, Trossard
Players wey no dey available: Smith Rowe), Jesus, Partey
Players wey fit no play : Ødegaard
Sevilla fit use dis line up: Dmitrović; Jesús Navas, Badé, Gudelj, Pedrosa; Soumaré, Sow, Rakitić; Lukebakio, En-Nesyri, Ocampos
Players wey no dey available: Acuña, Nyland, Ramos
Players wey fit no play: Fernando
Copenhagen vs Man United prediction

Wia dis foto come from, Getty Images
‘’Erik Ten Hag team form for Europe and Premier League get as e be dis season.’’ Wejinya tok.
Wen dem play Copenhagen for Old Trafford for matchday 3, di Red Devils manage win dat game 1-0.
''I expect Man United to struggle again for dis fixture and Copenhagen to raise dia game.'' E add.
''Di English side dey struggle to create chances and score goals, I feel say dis game go end for draw.'' E kotinu
Prediction: Copenhagen 1-1 Manchester United
Copenhagen vs Man Unitedkick- off time (21:00 pm West African time)
Copenhagen fit use dis line up: Grabara; Ankersen, Vavro, Diks, Jelert; Lerager, Falk, Diogo Gonçalves; Larsson, Claesson, Achouri
Players wey no dey available: Meling, Khocholava, Clem
Players wey fit no play: Cornelius, Boilesen, Elyounoussi
Players wey fit miss next match if dem collect card: Lerager, Meling
Man United fit use dis line up: Onana; Wan-Bissaka, Varane, Lindelöf, Dalot; Amrabat, McTominay; Mount, Bruno Fernandes, Garnacho; Højlund
Players wey no dey available: Shaw, Malacia, Mainoo, Diallo
Players wey fit no play: Maguire, Rashford
Real Madrid vs Braga prediction
‘’Real Madrid go wan stretch dia unbeaten run in all competitions to eight - against di Portuguese outfit wey bin chop 2-1 for di reverse fixture’’.Wejinya tok.
‘’I feel say dis game go easy for Real Madrid’’. E add.
Even though Braga neva lose since Real beat dem, dis game fit chook dem sake of di quality wey dey Carlo Ancelotti team
Prediction: Real Madrid 3-0 Braga
Real Madrid vs Braga kick- off time (21:00 pm West African time)
Real Madrid fit use dis line up: Arrizabalaga; Carvajal, Rüdiger, Alaba, Fran García; Valverde, Kroos, Camavinga; Bellingham; Rodrygo, Vinícius Júnior
Players wey no dey available: Courtois, Éder Militão, Tchouameni
Players wey fit no play: Ceballos, Bellingham, Mendy
Players wey fit miss next match if dem collect card: Camavinga
Braga fit use dis line up: Matheus; Cristian Borja, Paulo Oliveira, José Fonte, Victor Gómez; Al Musrati, Zalazar; Bruma, Álvaro Djaló, Ricardo Horta, Banza
Players wey no dey available: nobody
Players wey fit no play: nobody
Oda fixtures on match day 4 for Wednesday 7 November na
- Napoli vs Union Berlin (18:45)
- Real Sociedad vs Benfica (18:45)
- Bayern vs Galatasaray (21:00)
- PSV Eindhoven vs Lens (21:00)
- Salzburg vs Inter (21:00)













