US govment shut down - Why e hapun and wetin e mean

Wia dis foto come from, Getty Images
- Author, Anthony Zurcher
- Role, North America correspondent
- Author, James FitzGerald
- Read am in 7 mins
US govment don shut down for di first time in almost seven years afta member of Congress bin fail to agree on one last minute funding deal.
Di shut down go affect di funding govment operations through October and beyond and e go cause widespread disruption for Americans for areas wey range from air travel to zoo visits.
Di political gridlock also dey expected to put 40% of federal workforce – about 800,000 pipo – on unpaid leave.
National parks and museums fit close. Previous govment shutdowns bin lead to air travel disruption sake of staff shortages.
Di way forward neva dey clear as both sides don blame one anoda for di shutdown. Efforts for di Senate to keep di govment funded bin fail on Tuesday night, despite all di negotiations.
President Donald Trump don threaten mass firings and di cutting of some federal benefits wey e say dey important to Democrats.
Wetin be govment shutdown?
Shutdown of di federal govment mean say all non-essential functions of govment go dey frozen.
Dis go affect evritin from social security to air travel to national park access.
Federal agencies dey depend on funding wey go dey approved by Congress to allow di president to sign budget legislation for di fiscal year ahead.
If dem no fit approve approve funding sake of political differences, den dose agencies go dey forced to shut down.
E mean say workers no go fit go work and no go get paid.
How we reach here?

Wia dis foto come from, Anadolu via Getty Images
Di Senate need sixty votes to pass govment funding bill, dis one mean say even though na di Republicans dey control both chambers of Congress, dem go need Democratic backing to reopen govment.
One short-term Republican spending plan bin fail to win enough support on Tuesday, and dem also vote down one Democrat-led proposal.
Senators vote 55-45 in favour of di Republican-led bill, wey for keep di govment funding for di current levels e dey temporarily.
Di two sides don dey tackle each oda for some time now on top healthcare spending, as Democrats argue say any funding bill must include extension to health insurance subsidies wey go expire for di end of di year.
Many Republicans say di subsidies too cost, while odas bin propose introducing stricter eligibility rules bifor extending dem.
Earlier, di top Senate Democrat Chuck Schumer bin tok say Republicans dey try "bully" Democrats by refusing to negotiate on healthcare.
Trump bin blame Democrats for di standoff and e threaten to carry out mass firings of govment employees and reduce govment programmes and services wey e say dey important to Democrats if a shutdown occur.
"Di last tin we wan do na to shut down, but plenti beta tins fit come out from shutdowns," e tok on Tuesday. "We fit clear many tins wey we no want, and dem go be Democrat tins."
Trump meet Schumer on Monday, but dem fail to break di deadlock as Democrat tok later say "large differences" still dey.
Di president also say if dem no strike a deal "we fit do tins during di shutdown wey dey irreversible, wey dey bad for dem". Di White House bin suggest say a shutdown fit cause permanent firings of federal staff deemed "non-essential".
"We go sack plenty pipo," Trump tok.
Which impacts shutdown fit get - on national parks and social security and oda sectors?

Wia dis foto come from, Getty Images
No be all sectors of govment go shut down if Congress no pass spending bill.
Border protection, in-hospital medical care, law enforcement and air-traffic control go dey expected to continue to operate during di stoppage.
While dem go still send Social Security and Medicare cheques, benefit verification and card issuance fit stop.
Generally, in a shutdown, essential workers go continue to work as normal – dem no go pay some of dem for di time being - but dem go temporarily put govment employees wey dem reason as non-essential workers on unpaid leave. In di past, dem dey pay dis workers no mata what.
Dis one mean say services like di food assistance programme, federally funded pre-school, issuing of student loans, food inspections, and operations at national parks dey expected to close or reduce.
Travel delays fit also hapun if di stand-off drag on and unpaid workers stop to dey show up. Long shutdown fit also get secondary impacts on di US economy.
Flight travels
Federal govment shutdown go affect pipo wey dey travel by air in different ways. E go lead to long security queues, and delays wey unpaid air traffic controllers wey choose to stay for house instead of work for free cause.
Americans wey wan travel outside di kontri go also feel di impact, as US passport agencies don warn say e go take longer dan usual to process travel documents.
No work - or pay - for federal workers
Federal employees no go receive any pay cheque during di shutdown.
Some workers fit choose to take second jobs, as e hapun during previous shutdowns. Employees wey no be essential workers go dey forced to stay for house.
Several agencies, like di Centers for Disease Control and Prevention and di National Institutes of Health go likely layoff many workers, and e go affect ongoing research and experiments wey already dey in progress.
Contractors, wey dey work for federal agencies but wey no be govment employ directly go also miss out on work.
National Parks wit no staff
Dem dey close off federal lands, wey include National Parks and National Forests to visitors during past shutdowns, since dem ask di rangers plus oda employees to stay for house
During di last shutdown, Trump administration bin make di decision to leave parks open, wit few to no federal workers there to staff dem.
Health care for di elderly and poor
Medicare and Medicaid, social health programmes for di elderly and poor, go continue, but staffing shortages fit lead to some interruptions for certain services.
Emergency disaster relief fit no dey too affected, however oda work wey di disaster agencies dey do go dey affected.
Wetin be di difference about di White House response dis time?
Wetin stand out about dis current standoff na di position of di White House.
In di past, pipo dey see long shutdowns as politically dangerous, wey dey affect di evriday lives of voters, di images of lawmakers and di president.
But dis time around, di Trump administration be like say dem dey more dan happy to close large parts of di US govment for an extended period.
In fact, officials don threaten to use di shutdown to identify "non-essential" workers, wey dem fit sack permanently.
Also, afta previous shutdowns, govment operations dem dey most of di time return to normal, as staff and spending levels dey mostly go back to how dem dey bifor once dem resolve di standoff.
Ova di past nine months, Trump administration don cut spending and sack workers from dia jobs, testing di boundaries of presidential power.
A shutdown fit allow di administration to speed up dia massive reductions.
Shutdown dey common for US politics?

Shutdowns over budgets dey almost unique to US politics.
Under di US system, di different branches of govments get to reach agreement on spending plans bifor dem fit become law.
For most kontris, budget votes dey become votes of confidence for di govments demsefs. But bicos US get equal and often divided branches of govment, dat no be di case.










